1
John 8:12
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Den Jesus sey, “Na mi bi di lite wey dey di world, anybody wey follow mi, nor go waka for darkness lie-lie, but e go get di lite wey go gi-am life.”
เปรียบเทียบ
สำรวจ John 8:12
2
John 8:32
and una go know di trut and di trut go free una.”
สำรวจ John 8:32
3
John 8:31
Jesus kon tell di pipol wey kom from Judea wey bilive am, “If una obey wetin I dey tish una, den una go bi my disciples
สำรวจ John 8:31
4
John 8:36
So wen Man Pikin free una, una don dey free bi dat.
สำรวจ John 8:36
5
John 8:7
Wen dem kontinue to dey worry am, e kon get up tell dem, “Any of una wey neva kommit sin before, make e bi di first pesin to stone dis woman.”
สำรวจ John 8:7
6
John 8:34
Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una, anybody wey dey kommit sin, na sin bi di masta wey dey rule am.
สำรวจ John 8:34
7
John 8:10-11
Den Jesus stand up ask am, “Madam, where di pipol wey bring yu? Nobody remain to kondemn yu?” Di woman ansa, “Oga God, nobody remain.” Den Jesus tell am, “Mi too nor go kondemn yu. But from naw go, make yu nor sin again.”
สำรวจ John 8:10-11
หน้าหลัก
พระคัมภีร์
แผนการอ่าน
วิดีโอ