1
Matiu 26:41
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Open yor eye make yu pray, so dat yu nor go fall inside temptashon. Yor spirit won do am, but yor flesh dey weak.”
2
Matiu 26:38
Den e tell dem, “My heart heavy and e bi like sey I won die. Make una stay here and make una nor sleep.”
3
Matiu 26:39
E waka go front small kon liedan face groun, den e kon pray, “My Papa, if yu wont, yu go fit remove dis deat from mi! But nor bi as I wont, na as yu wont am.”
4
Matiu 26:28
bikos dis na my blood, wey bi di kovenant wey go make God forgive pipol dia sins.
5
Matiu 26:26
As dem dey chop, Jesus take bread kon tank God, afta e divide am, e give en disciples, kon sey, “Make una chop, dis na my body.”
6
Matiu 26:27
Afta, e take di cup kon tank God, den e give dem kon sey, “Make all of una drink from am
7
Matiu 26:40
Wen Jesus kom back, e kon si sey all en disciples dey sleep. Den e ask Pita, “So yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour?
8
Matiu 26:29
I tell una, from naw go, I nor go drink dis wine until di day wey I go drink di new wine with una for my Papa kingdom.”
9
Matiu 26:75
Den Pita kon remember wetin Jesus tell am, “Before fawol go make ‘Kukuruku’, yu go deny mi three times.” So Pita go outside bigin kry.
10
Matiu 26:46
Make una stand up, make wi dey go. Si! Di pesin wey won sell mi, don dey kom!”
11
Matiu 26:52
Den Jesus tell am, “Put yor swod for where e dey before! Bikos anybody wey dey karry swod, na swod go kill-am.