YouVersion Logo
Search Icon

Matiu 5

5
Jesus Prish On-top Mountin
1Wen Jesus si di pipol, e klimb go di mountin and en disciples follow am. Afta e don sidan, 2e kon bigin tish dem sey;
3“God go bless una wey dey poor for spirit,
na una go get heaven.
4God go bless una wey dey mourn,
bikos E go make una happy.
5God go bless una wey nor dey karry body up,
una go enjoy en promise for dis world.
6God go bless una wey dey like to do good tins,
E go give una evritin wey una wont.
7God go bless una wey dey sorry for pipol,
una go receive mesi.
8God go bless una wey get pure heart,
na una go si God.
9God go bless una wey dey make peace,
pipol go koll una God shidren.
10God go bless una wey dey sofa bikos una dey do wetin dey rite,
na una go enjoy God Kingdom for heaven.
11“God go bless una wey pipol dey curse, dey sofa and lie for una head, bikos of mi, 12make una happy and make belle sweet una, bikos na big tin dey wait una for heaven. Make una remember sey, na so di profets wey kom before una, sofa too.”
Salt And Lite
13“Na una bi salt for dis eart. But if salt nor get taste; how e go bi for pipol mout? E betta make dem trowey am and make pipol mash am.
14“Na una bi lite for dis world and town wey dey on-top mountin, nor dey hide. 15Pesin nor dey lite lamp kon kover am with basin, instead e go put am for where evribody wey dey inside di house go si am. 16Like dat too, make yor lite shine well-well for where pipol dey, so dat dem go si di good tins wey yu dey do, wey go make dem praiz yor Papa wey dey heaven.”
Tishing About Di Law
17“Make una nor tink sey I kom spoil Moses Law and di tins wey di profets tish. Nor bi so, misef kom obey dem. 18I tell una true word, before dis world go end, evritin wey dey inside di Law, even di small-small ones, go happen. 19So anybody wey nor do wetin God kommand and dey tish odas to do as e dey do, naim go small pass for God Kingdom. But pesin wey obey God and tish odas to do wetin di Law tok, na big pesin e go bi for God Kingdom. 20I tell yu di trut, if di good wey yu do, nor betta pass wetin di Farisee and di pipol wey dey tish di Law do, yu nor go fit enter God Kingdom.”
Tishing About Vexnashon And To Kill
21“Yu hear as God tell awa papa dem before-before sey, ‘Nor kill and anybody wey kill, God go judge am.’ 22But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.
23“If yu take gift go altar and yu kon remember sey yor broda get bad belle for yu, 24make yu leave di gift for di altar, first go setol with yor broda, den yu go fit kom back kon give yor gift.
25“Kwik setol with who dey akuiz yu before una rish kourt, if not, e go give yu to di judge and di warda go trow yu inside prison. 26I tell una di trut, yu nor go komot from dat trobol until yu pay all di money!”
Tishing About Adultery
27“Yu hear wey pipol sey, ‘Make yu nor sleep with who yu nor marry.’ 28But I dey tell una naw sey, ‘Anybody wey look woman kon get di mind to sleep with am, don already kommit sin for en heart.’ 29If yor rite eye go make yu sin, make yu plok am komot. E betta sey one part for yor body nor dey, dan sey all yor body enter hell-fire. 30If yor rite hand go make yu do bad tin, make yu kut am trowey! E betta sey one part for yor body nor dey, dan sey all yor body enter hell-fire.”
Tishing About Marriage
31“Pipol dey sey, ‘Anybody wey drive en wife, must gi-am paper sey e nor won marry am again.’ 32But I dey tell una naw sey, anybody wey drive en wife komot from marriage, wey nor bi sey di woman sleep with anoda man, don make di woman kommit adultery and any man wey marry di woman, don kommit adultery too.”
Tishing About Promise
33“Again, yu don hear sey dem tell pipol before-before sey, ‘Make yu nor break yor promise, but do wetin yu promise God.’ 34But I dey tell una naw sey, make una nor ever use heaven swear at-all, bikos na God throne e bi, 35or with eart, bikos naim God dey put en leg, or use Jerusalem, bikos na di big king town 36Nor even take yor head swear, bikos yu nor fit make one singol hair white or black. 37Wen yu sey, ‘Yes,’ make yu mean am and wen yu sey ‘No,’ make yu mean am too. Any oda tin wey yu tok pass dis, na devil e from kom.”
Tishing About Revensh
38“Una hear sey, ‘Anytin anybody do una, make una do am back.’ 39But I tell una, make una nor fight, if anybody slap yor face, turn di oda side gi-am too. 40If anybody drag yor shirt with yu, make yu gi-am yor koat join. 41And if anybody force yu waka one mile, make yu follow am waka two mile. 42Give pipol anytin wey dem ask from yu and nor drive anybody wey kom borrow sometin from yu.”
Love Yor Enemy
43“Una hear sey, ‘Make una love una neighbour and hate una enemy.’ 44But I tell una naw sey, ‘Make una love una enemies and pray for pipol wey dey sofa una’, 45so dat una go bi like una Papa for heaven wey dey allow sun to shine and rain to fall on-top bad and good pipol. 46If una love only di pipol wey love una, wetin una go gain? Na so bad pipol dey do too, abi nor bi so? 47If una dey greet only una brodas, una nor betta pass odas, bikos pipol wey nor know God still dey do like dat, abi nor bi so? 48So make una dey pafet as una Papa wey dey for heaven, pafet.”

Currently Selected:

Matiu 5: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy