Zekaraya 11
11
Judah Wiked Kings
1Lebanon, make yu open yor gate,
so dat fire go burn yor cedar tree rish groun!
2Cypress, make yu kry take body nak groun,
bikos di cedar trees don die
and doz fine-fine trees don dey yuzles!
Bashan oak trees, make una kry take body nak groun,
bikos dem don kut una for groun!
3Make una si as doz wey dey lead di pipol dey kry,
bikos dia glory don vanish!
Make una listin as lions dey shaut,
bikos dem don distroy di bush where dem dey stay,
near Jordan River!
4Di Oga my God tell mi, “Make yu bihave like shepad wey dem won go kill all en sheep. 5Wen who get sheep kill en sheep, anybody go ponish am? E go sell di meat finish kon sey, ‘Make wi praiz God wey don give us plenty money!’ So who even get sheep, nor dey sorry for dem.”
6So God sey, “I nor go sorry for anybody for dis land again. Na mi mysef go put all di pipol under dia ruler pawa. Di ruler go distroy di eart and I nor go save pipol from en pawa.”
7Na pipol wey dey buy and sell di sheep, hire mi and I kon turn shepad wey dem won go kill en sheep. I take two stik kon koll one, “Favor” and di oda one na, “Unity.” So I kon dey kare for di sheep dem. 8Na one mont I take kill di three oda shepad wey hate mi, bikos I nor like dem too. 9Den I tell di sheep sey, “I nor go bi una shepad again. So doz wey won die, make dem die and doz wey dem go distroy, make dem distroy dem. Doz wey remain, go distroy each oda.”
10So I take di stik wey dem dey koll “Favor” kon break am take kansol di kovenant wey God make with di pipol. 11I kansol di kovenant dat same day. Di pipol wey dey buy and sell di sheep dey look mi and dem know sey God gri with evritin wey I dey do.
12So I tell dem, “If una wont, make una give mi my money, but una fit keep di money if una like am like dat.” So dem pay mi thirty silva. 13God kon tell mi, “Make yu put dem for di temple pus.” So I take di thirty silva, di money wey dem feel sey dem fit take buy mi kon put am for di temple pus. 14I break di sekond stik wey bi “Unity” and di unity wey dey among Judah and Israel pipol kon skata.
15Den God tell mi, “Make yu bihave like sey yu bi shepad again. Dis time, yu go bihave like yuzles profet. 16Even doh I put shepad make e kare for my sheep, e nor go fit do anytin wen odas dey treaten to distroy di sheep. E nor kare about di ones wey lost or wound or to even feed di odas. Instead, e dey kill di betta ones chop kon trowey di rest part for bush.
17“Doz wiked shepad go die finish!
Dem don leave dia sheep.
Dem nor go get pawa again;
dem nor go fit karry dia hand take fight
and dia eyes go blind.”
Currently Selected:
Zekaraya 11: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: