YouVersion Logo
Search Icon

Titus 2

2
Good Tishing
1But for yu Titus, yu must tish pipol how to bihave well. 2Make yu tish old men sey, make dem nor dey bihave anyhow, so dat pipol go respet dem and make dem dey kontrol demsef; get faith; dey show love and dey patient. 3Make yu tish old wimen sey, make dem live life wey go make God happy. Make dem nor tok bad about pipol; nor dey drink anyhow, instead make dem tish oda wimen wetin dey good. 4So, make di old wimen train and tish di yong ones how dem go take love dia husband and shidren; 5to dey kontrol diasef; get pure mind; dey do dia house work well; dey kare for pipol; dey do as dia husband wont, so dat pipol nor go tok anyhow about God word wey wi dey prish so. 6Make yu tish yong men to dey live dia life with betta sense 7and make yu yorsef bi good ezample to dem. Make evritin wey yu dey do, show sey wetin yu dey tish, na trut. 8Make yu prish di trut, so dat pipol nor go get rizin to tok against yu. Den doz wey dey oppoz yu, go shame and dem nor go get word to tok about us. 9Una wey bi savant, make una dey do evritin wey una oga wont and wen una oga tok to una, make una nor dey ansa am anyhow. 10Make una nor dey tif, instead make una dey show sey una get faith, so dat evritin wey una dey do, go bring praiz to God awa Savior.
11Bikos God grace wey bring salvashon, don kom out make evribody si am. 12Di grace dey tish us sey, make wi nor live like pipol wey nor know God or dey bihave anyhow. So make wi dey kontrol awasef; dey do good and follow God for dis time wey wi dey so, 13bikos wi dey wait for di day wen God sey Christ, wey bi awa God Almighty and Savior, go kom. 14E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins. 15Make yu tish dem dis tins and korrect dem with boldness. So, make yu nor let anybody trit yu like small pikin.

Currently Selected:

Titus 2: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in