Song of Songs 7
7
Di Man
1Fine woman! Make yu si as yor leg fine for inside sandal.
Yor lap round like gold wey betta goldsmit make.
2Yor pompu round like cup wey full with wine wey dem mix.
Yor belle bi like many korn seed wey lily gada round.
3Yor two breast bi like gazelle
or deer wey bi twins.
4Yor neck fine just like ivory towa
and yor eyes bi like Heshbon Pool
wey dey shine near Bat-Rabbim Gate.
Yor nose fine like Lebanon towa
wey face Damaskus.
5Yor head fine like Mount Karmel.
Yor hair dey shine like design wey dey di king garment.
Di wey e fine, dey sopraiz di king well-well.
6So my love, make yu si as yu fine rish!
Yes! Yu too fine;
si as love make yu komplete well-well.
7Yu slim like palm tree
and yor breast bi like palm fruit.
8I sey, “I go klimb di tree kon plok en fruit.
To mi, yor breast bi like grape and di smell from yor nose,
dey scent like apple.”
9So make yor mout taste like di wine wey good pass,
wey go flow small-small enter awa lips wen wi dey sleep togeda.
Di Woman
10I bilong to my love
and e don take mi as en own.
11My love, kom dis nite
make wi go sleep on-top di flowers for di field.
12Make wi wake-up for early morning go di vineyard,
so dat wi go si weda di grape vine don get new leaf
and if di leafs don open
or if di pomegranate fruit don dey grow.
And na for der I go for give yu my love.
13Di mandrake fruit and di fruit wey fine pass,
dey give us sweet smell.
My darlin, difren kind of good tins dey awa door-mot
and I don keep both old and new wons for yu.
Currently Selected:
Song of Songs 7: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee