Song of Songs 6
6
Di Wimen
1Woman wey fine pass among oda wimen,
na where yor love go?
Na wish place e pass,
so dat wi go help yu go find am?
Di Woman
2My love don go en gardin;
e don go where sweet spices dey.
Na for der, e go feed en animals
kon gada lily flowers.
3I bilong to my love and e bilong to mi.
E dey feed en animals among di lily flowers for di valley.
Di Man
4My darlin, yu fine like Tirzah town.
Yes! Yu fine like Jerusalem kon sweet like di great town.
5Nor look mi with yor eyes,
bikos dem dey sweet mi for body.
Yor hair skata like goat
wey dey kom down from Gilead Mount.
6Yor tit white like sheep wey dem just wosh klean;
each of di tit na two dem bi and dem komplete.
7Even with di lite klot wey yu take kover,
yor jaw still bi like pomegranate fruit.
8Even if I get sixty kweens,
eighty girl-friends and many wimen around mi,
9na-im bi di only one wey I love
and e fine like dove.
Na-im bi di only girl wey en mama born
and en mama like am well-well.
So evry woman dey bless am;
even di kweens and my girl-friends dey praiz am.
10“So, who bi dis wey appear like morning lite;
wey fine like moon;
dey shine like sun kon get stars like soja wey get many rank?”
11I go di place where dem plant walnut tree
kon from der dey fine di valley bottom
so dat I go si if di plants don grow or if dem dey shine well.
12But before I know,
I si mysef for di royal war horse with my love.
Di Woman
13Make yu kom back. Abeg!
Make yu kwik kom back,
so dat wi go fit si and look yor face again!
Why una wont make dis Shullam woman dance
Mahanaim style with di odas?
Currently Selected:
Song of Songs 6: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

:
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee