YouVersion Logo
Search Icon

Song of Songs 4

4
Di Man
1My darlin, yu too fine!
I nor fit diskribe as yu fine rish.
Even with di lite klot wey yu take kover face,
yor eyes still dey shine like dove own.
Yor hair dey dance like woman goat
wey dey kom from Mount Gilead.
2Yor tit dey white like sheep wey dem just barber en hair kon wosh en body klean.
Yor tit komplete and all of dem mash each oda.
3Yor lips bi like red klot;
yor mout sweet well-well.
Yor fore head for di lite klot wey yu take kover,
bi like pomegranate fruit.
4Yor neck fine well-well like David towa and e round and smooth
and yu wear necklace wey get 1,000 tins wey dey guide am.
5Yor two breast bi like gazelle or deer
wey bi twins wey dey chop for where lily flower dey.
6Before di morning breeze go blow and darkness go disappear,
I go hurry go myrrh mountin and incense hill.
7My love, yu too fine
and dey pafet!
8My wife to bi, make yu follow mi from Lebanon.
Make yu kom down from Mount Amanah,
from Senir and Hermon and where lion and leopard dey stay.
9My sista and wife, yu don tif my heart!
Only di way yu dey look mi and di necklace wey yu wear,
don tif my heart.
10My sista and wife to bi, yor love dey sweet mi for body.
Yor love betta pass wine and yor perfume scent pass spices.
11My wife to bi, yor lip sweet like honey,
bikos honey and milk dey under yor tongue.
Yor klot dey scent like cedar for Lebanon.
12My sista and wife, yu bi my sekret gardin;
my fine gardin wey get en own well.
13Yu bi royal gardin wey pomegranate fruit and fine fruit
like Hena and Nard tree, full:
14Nard and saffron flower;
kalamus and sinamon with difren spice, myrrh, aloe
and some oda fine-fine spice, still dey der too.
15Yu bi gardin wey get fountain;
well wey get fresh wota wey dey kom down from Mount Lebanon.
Di Woman
16Breeze from nort, make yu wake-up!
Breeze from sout, make yu blow my gardin
kon spread yor scent round am.
My love, make yu kom my gardin
kon taste en betta fruit.

Currently Selected:

Song of Songs 4: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in