Romans 8
8
Holy Spirit Life
1So, God nor go kondemn pipol wey bilive Jesus Christ. 2Since di Holy Spirit don give una life wey kom from Jesus Christ, e go free una from sin and deat. 3Moses Law nor fit do dis tins, bikos di yeye life wey wi dey live don make di law weak. But God don free us wen E send en pikin kom like human being wey bi sina, make e for sakrifice ensef for awa sins. 4God do so, so dat wetin di law tok, go happen wen wi obey di Spirit, instead of awa own mind.
5Bikos pipol wey dey live by dia own mind, dey tink of only demsef. But evribody wey di Holy Spirit dey rule, dey tink of tins wey di Spirit wont. 6If wi let sin rule awa mind, wi go die. But if na di Spirit dey rule us, wi go get life and peace. 7Pipol wey dey sin, na God enemy dem bi, bikos dem nor obey en law, since dem nor fit obey am. 8Doz wey dey obey sin, nor go fit make God happy. 9But una nor dey obey sin, instead, na as di Spirit sey make una live, na so una dey live. 10Christ dey live inside una. So una dey alive, bikos God don asept una, even doh una body must die, bikos of una sins. 11If God Spirit wey raiz Jesus Christ from deat dey inside una, den en wey raiz Christ from deat, go give una body life, bikos of en Spirit wey dey inside una.
12So my brodas and sistas, wi get work to do for God, so make wi nor live as awa body wont. 13Bikos if una dey follow sin, una go die. But di Spirit pawa go kill all di bad tins wey una dey do, so dat una go get life. 14Na doz wey God Spirit dey lead, bi God shidren. 15Di Spirit wey God give us nor go make us fear like slave, instead, wi bi God shidren and wi dey koll am, “Awa Papa!” 16Na God Spirit make us know sey wi bi God shidren. 17And if wi bi God shidren, den wi go inherit God propaty. Yes, wi go follow Christ inherit God propaty, bikos if really wi sofa with am, wi go follow am enjoy.
Glory For Front
18I dey sure sey, wi nor go fit kompare all di sofa wey wi dey sofa naw, with di glory wey God go give us. 19Evritin wey God kreate for dis world, dey wait for God to show en shidren to di world. 20Bikos of sin, di world dey sofa from God curse naw and nor bi bikos dem wont am like dat. But di world dey hope 21sey one day, God go free dem from deat and wahala and dem go-go join en shidren wey E don save. 22Wi know sey evritin wey God kreate, dey kry, just like di way woman wey won born dey kry. 23Di Holy Spirit don make us dey sure of how tumoro go bi. But naw, wi dey struggol as wi dey wait make God show sey wi bi en shidren, den E go kon save us. 24Na dis hope save us. But if wi don already get wetin wi dey hope for, den wi nor nid to dey hope again. Abi who dey hope for wetin e don already get? 25But if wi put hope for wetin wi nor fit si, wi go take all awa mind wait for am with patient. 26Na so too di Holy Spirit dey help us bikos wi dey weak. Bikos wi nor know wetin wi suppose to pray for, di Spirit by ensef dey kry beg God, for di way awa word nor go fit esplain. 27And God wey dey si evritin inside awa belle, know wetin dey di Spirit mind, bikos di Spirit dey pray for all God pipol, as God wont.
28And wi know sey evritin dey work for awa good, bikos wi love God and dey do wetin E wont. 29God know doz wey E don choose, so E don make dem bi like en Pikin, so dat en pikin go bi di first-born. 30Doz wey God don asept, na dem E koll; doz wey E koll, na dem E make raitious and E kon share en glory with dem.
31Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us? 32True-true, if E let dem kill en own pikin for awa sins, den E go fit give us evritin wey wi ask from am free of sharge! 33Who go fit akuiz pesin wey God don choose? Na God know who good or bad. 34Who bi di pesin wey go kondemn us? Na Jesus Christ wey die for us; di pesin wey God raiz from deat and naw, e dey for God rite hand side dey pray for us. 35Na who go fit separate us from Christ love? Na trobol or opreshon; honga or poverty; wahala or deat; or na bikos klot nor dey to wear? 36As dem rite am, “Bikos of una, wi dey face deat from morning go rish nite and wi bi like sheep wey dem won go kill.” 37Inside all dis tins, awa joy don dey full, bikos Jesus love us! 38But I dey sure sey, weda na deat or life; angels or wiked pawas; tins wey dey naw or di ones wey dey kom; 39tins wey dey heaven; tins for under dis eart or anytin wey God kreate, non of dem go fit separate us from God love, bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.
Currently Selected:
Romans 8: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: