Romans 16
16
Paul Greetin
1I get betta tins to tok about awa sista, Foebe, wey bi leader for di church wey dey Cenchrea. 2Make una welkom am with God name as God shidren suppose do. And make una gi-am anytin wey e nid; bikos e don help mi and oda pipol before.
3Make una salot Priscilla and Akwila for mi. Dem bi my ko-workers for awa Oga God Jesus Christ work, 4dem don even risk dia life bikos of mi. So, mi and di whole church dey tank dem well-well. 5Make una still help mi salot di pipol for di church wey dey meet for dia house. Salot Epaenetus, my good friend (di first pesin to bilive Christ for Asia). 6Greet Mary wey don work well-well with una. 7Make una greet my kousin Andronikus and Junia wey dey prison with mi before. Di apostles dey respet dem and dem too don dey follow God, before I even know Christ. 8Greet Ampliatus, wey get faith and e bi my good friend. 9Greet Urbanus wey follow us work. Greet Stachys wey bi my good friend. 10Make una greet Apelles for mi, bikos Jesus Christ don choose am. Den make una still greet Aristobulus family for mi. 11Make una greet Herodion my kountry man and Narcissus and en family wey don bilive God. 12Greet Trifena and Trifosa and my friend Persis wey dey do Christ work. 13Greet Rufus, di pesin wey di Oga God don choose and en mama wey trit mi like sey e bi my mama. 14Make una greet Asynkritus, Flegon, Hermes, Patrobas, Hermas and all di brodas and sistas wey dey with dem. 15Greet Filologus and Julia, Nereus and en sista, Olympas and all di bilivers wey dey with dem. 16Make una salot one anoda with kiss for jaw. All di church wey bi Christ own, dey greet una.
17Naw, my brodas and sistas, I dey beg una, make una know di pipol wey dey kause wahala and oppoz di tishing wey una don learn from us. Den make una nor go near dem! 18Bikos dis kind pipol nor dey serve awa Oga God Jesus Christ, but na dia belle dem dey kare for. With dia sweet and wayo mout, dem go praiz and deceive pipol wey nor wise. 19I dey happy, bikos evribody don know how una dey obey God. But I wont make una dey wise wen e rish matter wey koncern wetin dey good or bad. Make una nor do any bad tin. 20And God wey dey give peace, go soon distroy Satan for una. Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una.
21Timoti, my ko-worker; Lucius, Jason and Sosipater my kountry man, all of dem dey greet una. 22Even mi, Tertius wey rite dis leta, dey greet una with Christ name. 23Gaius, wey dey kare for mi and di church, dey greet una. Erastus wey bi di town treasurer and awa broda Kwartus, dey greet una. 24Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una!
Final Word
25Make wi praiz God, bikos e don make una strong thru dis Good News wey I dey prish about en pikin, Jesus Christ. For many years naw, dem keep dis message for sekret, 26but naw, dem don tok am at last. God wey nor dey die, kommand en profets make dem rite about di Good News, so dat pipol for evriwhere, go obey am and get faith. 27Naw, wi dey praiz di only God wey dey wise forever, bikos of Jesus Christ! Amen.
Currently Selected:
Romans 16: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee