Romans 15
15
Make yu Please Odas
1If awa faith dey strong, den make wi dey patient with doz wey get weak faith. Make wi try to make dem happy, instead of awasef. 2Make wi tink of tins wey good for dem, den do wetin go make dem grow. 3Even Christ nor do tins wey go just make ensef happy, but just as dem rite for God word, “Di pesin wey curse yu, don curse mi.” 4Bikos evritin wey dem rite from biginnin, na to tish, enkourage and give us hope. 5So, I pray sey, God wey dey give konfort and patient, go help una live for peace with one anoda as una dey follow Jesus Christ, 6so dat as una dey togeda, una go fit use one vois praiz God, wey bi awa Oga God Jesus Christ, Papa.
Asept One Anoda
7So make una asept one anoda just as Christ asept una, so dat God go get all di glory. 8Make I tell una di trut, Christ kom as Jew pipol savant to show sey, God don keep di promise wey E make with dia grand-grand papa dem. Christ still kom, 9so dat Gentile pipol go praiz God sey e dey good to dem. Just as God word sey, “I go tell Gentile pipol about yu and I go sing, dey praiz yor name.” 10God word still sey, “Gentile pipol! Make una happy with God pipol.” 11Dem rite am for God word sey, “Una wey bi Gentile pipol, make una praiz God. Make evribody praiz am.” 12Profet Isaya sey, “Somebody dey kom from David family (Jesse rut). E go rule Gentile pipol and dem go bilive am.” 13I pray make God wey dey give hope, bless una with joy and peace bikos of una faith. So make di Holy Spirit pawa full una body with faith.
Why Paul Rite Dis Leta
14My friends, I dey sure sey una dey good; know God well-well and fit tish one anoda. 15But for dis leta, I rite some tins with boldness, so dat una go remember dem well-well. God dey good to mi and 16naim make am choose mi to bi Jesus Christ savant for Gentile pipol and make I for dey prish di Good News. Dis tin happen, so dat di Holy Spirit go make God dey happy with Gentile pipol.
17So I dey boast about di tins wey I dey do, bikos of Jesus Christ. 18With betta mind, evritin wey I dey tok about, na how Christ let mi tok and work, so dat Gentile pipol go obey am. 19Yes! I go tok how Christ take do many mirakles and wonders thru di Holy Spirit pawa. I don prish di Good News from Jerusalem go rish Illyricum. 20But I like to prish di Good News for where pipol nor know Christ, so dat I nor go build house on-top anoda man foundashon, 21just as God word sey, “Doz wey dem tell about am, go si am and doz wey neva hear about am, dem go undastand.”
Paul Plan To Visit Rome
22My work neva let mi kom si una. 23But naw, nor-tin remain wey I go do for dis part for di world again and e don tey wey I dey plan to kom visit una. 24I go plan to stop si una wen I dey go Spain, so dat una go help mi for di journey, afta I don stay with una for sometaim.
25But naw, I dey take message go give God pipol for Jerusalem, 26bikos God pipol for Masidonia and Akaia give mi money make I give di poor Christians for der. 27Dis na wetin dem really won do. Bikos wen den share di tins wey dem get with Jew pipol, den dem don follow Jew pipol share dia spiritual blessings too. 28So, afta I don finish dis work kon dey sure sey di bilivers don get dia blessings for Jerusalem, I go visit una wen I dey go Spain. 29And I know sey wen I kom visit una, I go bring plenty blessings from Christ kon give una.
30My brodas and sistas, I dey beg una with Jesus Christ and di Holy Spirit love; make una help mi pray to God. 31Make una pray make God save mi from pipol wey nor bilive am for Judea and make di bilivers wey dey Jerusalem, asept wetin I dey prish. 32Make una pray give God, so dat I go kom visit una with happiness. 33So make God wey dey give peace, dey with all of una. Amen.
Currently Selected:
Romans 15: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: