YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 147

147
Praiz God Wey Get Pawa
1Make wi praiz God!
Si as e dey good to sing praiz God!
Yes, na to praiz God bi di rite tin to do!
2God dey ribuild Jerusalem and E go bring en pipol
kom back to Israel from di land where dem dey.
3E heal pipol wey dia heart don break
kon trit dia sore.
4E dey kount
and koll di stars by dia names.
5Si as awa Oga God big rish!
En pawa dey wonderful!
Nobody fit undastand how God take dey know tins!
6God dey support pipol wey nor dey karry body up,
but E dey kill wiked pipol trowey.
7So, make una sing tank God;
make una use harp take sing praiz awa God.
8E kover di heavens with kloud kon make rain fall for di eart,
den E make grass grow on-top mountins.
9E dey give food to wild animals
kon feed di yong birds wen dem dey kry.
10E nor kare about di pawa wey horse get
or di one wey human being get.
11No! But God dey happy for pipol wey dey fear and obey am;
doz wey put dia hope for en love wey nor dey fail.
12So, Jerusalem pipol!
Make una praiz God!
Pipol for Zion, make una gi-am all di praiz!
13Bikos E don make di iron for una gate strong
kon bless all una shidren.
14E send peace kom una land
kon make una chop betta food.
15E send en laws kom di world;
so make una si as en word kwik kom meet una!
16E send snow kom like as wool dey fall;
E skata snow for groun like ashes.
17E trow big-big stones with fire kom di eart.
So, na who fit stand face God kold breeze
wey fit turn pesin to ice-blok?
18But as E kommand, di kold breeze and ice-blok kon melt.
E send en breeze and di ice-blok kon turn wota.
19E don show Jakob en word,
kommands and rules for Israel pipol.
20E neva do like dis for any oda nashon;
no oda nashon know en rules and kommand.
So make wi praiz God!

Currently Selected:

Psalms 147: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in