YouVersion Logo
Search Icon

Proverbs 26

26
1Just as pipol nor dey espect rain for dry sizin,
na so too, respet nor good for foolish pesin.
2Just as bird dey fly pass, na so too,
curse wey dem put for yor head and yu nor deserve am,
nor go do yu anytin.
3E dey eazy to whip horse and kontrol donkey,
but e nor eazy to kontrol foolish pesin.
4If yu ansa yeye kweshon wey foolish pesin ask,
den yu dey foolish, just like di pesin wey ask yu.
5Make yu ansa fool akordin to en kweshon,
so dat e go know sey e nor wise as e tink,
but if yu nor ansa am, yusef go bi fool like am.
6Just as if pesin kut en own leg komot,
na so e bi too to send fool message,
bikos na trobol di pesin dey look for.
7As pesin wey en leg cripple nor fit use am,
na so too foolish pipol words dey yuzles.
8To praiz foolish pesin bi like to put stone for katapault
kon ready to shot am.
9Like shuku-shuku wey shuk drunkard man hand,
na so too wise word bi for foolish pesin mout.
10Like pesin wey dey shot en arrow anyhow,
na so too e bi to pesin wey hire fool take work.
11Just as dog dey go back go chop en vomit,
na so fool dey always show en foolishness.
12Pesin wey foolish well-well,
betta pass pesin wey tink sey e wise,
but e nor get sense.
13Lazy pesin go sey, “Lion dey for outside!
Many lion dey evriwhere for di street!”
14Lazy pesin go just dey turn up-and-down for bed
like door handle and
15some pipol too lazy to even put food for dia own mout.
16Lazy pesin go tink sey en wise
pass seven pipol wey get sense well-well.
17Pesin wey go argue matter wey nor koncern am,
bi like wen yu dey waka for road
kon go hold dog for en ear.
18Just as e bad for mad pesin
to play with bow and arrow,
19na so too e bi with pesin wey deceive en neighbour
and e sey, “Nor bi joke I dey joke?”
20Fire nor dey katch without wood;
so without aproko, kworel nor go dey.
21Pipol wey like wahala dey kause trobol,
just as mashes and kerosine dey start fire.
22Aproko story dey sweet some pipol well-well,
but to odas, e dey pain well-well go rish dia bones.
23Pesin wey get wiked heart and dey lie well-well,
bi like fine klot wey dem take kover klay pot,
so dat pipol go tink sey na betta tin dey der.
24Pesin wey hate odas and dey pritend sey e like dem,
na wikedness full en heart.
25Even doh e tok sweet words,
make yu nor bilive am, bikos na wikedness full en belle.
26E fit hide en wikedness,
but evribody go soon si di bad tins wey e dey do.
27So, anybody wey dig pit for pesin
go fall inside my ensef
and pesin wey roll stone to wound odas,
na di stone go fall kill-am.
28Na only pesin wey yu hate, yu go
like lie against and yeye words dey distroy pipol.

Currently Selected:

Proverbs 26: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in