YouVersion Logo
Search Icon

Proverbs 23

23
Di Sixt Word
1Wen yu sidan dey chop with important pesin,
make yu dey kareful well-well.
2If yu dey too chop and nor dey beleful,
make yu respet yorsef.
3Nor get long-trot for di fine food wey e give yu;
bikos e fit use am take deceive yu.
Di Sevent Word
4As yu dey try to get money,
make yu use yor sense, so dat life nor go taya yu,
5bikos yor money fit finish wons like sey e get feada
kon fly leave yu like eagle.
Di Eight Word
6Make yu nor chop with stingy pesin
or get long-trot for di kind food wey e kook,
7bikos e go sey,
“Make yu kom chop!”
But e nor really tok am from en heart,
bikos na as e dey tink, na so too e bi.
8Yu go vomit all wetin yu don chop,
den all di praiz wey yu praiz am, nor go mean anytin again.
Di Ninet Word
9Make yu nor try to tok sense give foolish pesin,
bikos e nor go value am.
Di Tent Word
10Make yu nor remove di old boundary stone wey yor grand-grand papa dem take mark land and pikin wey
nor get papa and mama, make yu nor take en land.
11Na God dey defend dem
and E go judge dia kase against yu.
Di Elevent Word
12Make yu listin to yor tishas
kon learn evritin wey yu fit learn.
Di Twelft Word
13Make yu always ponish shidren wen dem do wrong,
bikos dat ponishment nor go kill dem,
14but e go save dia life.
Di Thirtint Word
15My pikin, if yu dey wise,
I go happy well-well.
16I go dey proud
wen I hear yu dey tok with wisdom.
Di Fortint Word
17Make yu nor jealous sinnas,
but make to dey fear God,
bi di only tin wey koncern yu for dis life.
18If e bi like dat,
den yor future go dey sikure.
Di Fifteent Word
19Listin my pikin; make yu get sense
and tink how yu dey live yor life.
20Nor make friend with pipol
wey dey drink wine too mush or chop well-well,
21bikos pipol wey dey drink and chop too mush,
go soon luz evritin.
So, If all wetin yu dey do na to dey chop and sleep,
den yu go soon start to wear rag.
Di Sixteent Word
22Listin to yor papa; bikos without am, yu nor go dey dis world
and wen yor mama don old, make yu still dey respet am.
23Make yu do anytin to get wisdom,
trut, undastand and good sense
and if yu get dem, make yu nor sell dem,
bikos dem go help yu well-well.
24Good pesin papa get betta rizin to happy
and e go dey happy if en pikin get wisdom.
25Make yu do wetin go make yor papa and mama happy for yu,
so dat yor mama nor go regret sey e born yu.
Di Seventint Word
26My pikin, listin well-well
and make my life bi ezample to yu.
27Ashawo and wimen wey dey bihave anyhow,
na wiked trap dem bi.
28Dem dey wait for yu like sey dem bi tif
and dem don make many men sin against dia wifes.
Di Eighteent Word
29Na who dem dey curse? Na who dey face trobol?
Na who get enough? Na who dey komplain?
Na who sore full en body? Na who nor dey fit si well?
30Na doz wey dey struggol to drink wine
and doz wey dey waka dey find new wine to drink.
31So, make yu nor allow wine tempt yu,
even doh e red well-well
or dey shine for di cup and dey sweet for mout.
32Bikos di next morning,
e go bi like sey na snake wey get poizin, bite yu.
33Yor eyes go si tins wey go sopraiz yu
and yu nor go fit tink or tok well.
34Yu go bi like pesin wey sleep near river
or on-top boat for wota.
35Yu go sey, “Dem attack mi, but I nor wound!
Dem beat mi, but I nor remember.
‘Wen I go take stand up for bed,
so dat I go-go find anoda drink?’ ”

Currently Selected:

Proverbs 23: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in