Proverbs 20
20
1Too mush drink dey make pesin tok and bihave anyhow
and pesin wey dey drink too mush, nor get sense.
2Wen king vex, e bi like lion wey dey shaut;
to make am vex, mean sey yu won kill yorsef.
3Na only foolish pesin dey start kworel;
so di rite tin to do, na to run from am.
4Farmer wey lazy well-well to klear en farm for di rite time,
nor go get anytin to harvest.
5Betta advise for pesin heart bi like wota for inside deep well,
but pesin wey get wisdom go draw am kom out.
6Some pipol dey tok how dem dey honbol and faithful,
but e go hard to find pesin wey really bi like dat.
7Good pipol dey always do di rite tin
and God dey bless dia shidren.
8Wen king sidan for en throne dey judge,
e dey fit know bad tin wen e si am.
9E get anybody wey fit sey en mind klean well-well
and e nor dey sin?
10God hate pipol wey dey weigh
and measure tins with wayo.
11Even shidren dey show who dem bi with wetin dem dey do;
den yu go fit know if dem good and dey honest.
12Na God give us eyes to si tins
and ear to hear word.
13If na so-so sleep yu dey sleep, na poverty go kill yu.
But if yu dey work hard, yu go get plenty food to chop.
14Pesin wey dey buy sometin go sey,
“Dis tin too dear! E too dear!”
But afta e don buy am, e go-go make mout sey
“Dis tin wey I buy so, cheap well-well.”
15To tok with wisdom,
betta pass to get gold and silva.
16Anybody wey promise sey e go pay strenja debt,
make una hold en propaty until e pay am.
Make una hold di propaty if e dey do am
for pesin wey kom from anoda kountry.
17Bread wey pesin tif dey sweet for mout,
but e go bi like stone for en belle.
18Make yu dey sure sey dem advise yu well,
before yu make any plan or go start war.
19Pesin wey dey do aproko nor go fit keep sekret.
So make yu run from pesin wey dey tok too mush.
20If yu curse yor papa and mama,
yor life go end like lantan wey kwensh for darkness.
21Propaty wey pesin use wayo take kwik get for life,
nor dey last.
22Nor do bad to pesin wey do yu bad,
but make yu trust God and E go save yu.
23God nor like pipol wey dey weigh
and measure tins with wayo.
24Na God dey direct pesin;
so how pesin won use en own mind take know as en life go bi?
25E nor good make yu promise God
wetin yu know sey yu nor go do.
26Wise king dey skata wiked pipol like flower
kon ride horse on-top dem.
27God lite dey enter human being spirit
kon open all di plans wey dem get.
28Love wey nor dey fail and goodness dey protet di king
and na dis love dey make en throne dey forever.
29Yong pipol glory dey dia strent;
so make una respet di white hair wey old pipol get.
30Korrect ponishment dey drive evil komot from pesin mind
kon make en heart klean.
Currently Selected:
Proverbs 20: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: