Proverbs 14
14
1Wise woman dey build en house,
but foolish woman dey skata en own with en hand.
2Doz wey dey do wetin dey good, dey fear God;
but doz wey dey do wiked tins, nor dey fear am at-all.
3Foolish words go make dem flog pesin,
but wise pesin words, go save en life.
4If pesin nor get melu wey go work for en farm,
food nor go dey for am to chop,
but strong melu wey sabi work,
go make yor korn plenty.
5Good witness nor dey lie,
but na lie-lie, wiked pipol dey tok.
6Pipol wey karry body up dey find wisdom, but dem nor go si am,
but undastandin dey eazy for pesin wey get sense.
7Make yu waka leave foolish pesin, if not,
yu nor go undastand wen wise pesin dey tok to yu.
8Wise pipol know where dem dey go,
but foolish pipol dey deceive demsef.
9Foolish pipol dey laf dia own foolishness,
but doz wey dey fear God,
dey know and ask for forgivenes.
10As yu dey happy wen good tin happen to yu,
na so too e go bi wen pain kom.
Nobody go fit share dem with yu.
11Dem go distroy wiked pipol house,
but doz wey dey fear God, go prosper.
12Wetin pesin dey do fit dey korrect for en eye,
but e dey lead am to en grave.
13Wen pesin dey laf, e go forget en pain,
but wen di happiness don end, di pain go kom back.
14Just as doz wey dey judge odas dey get wetin dem deserve;
na so too good pipol dey get dia reward.
15Doz wey nor get sense dey bilive evritin wey pipol tell dem!
But wise man dey wosh en step.
16Wise pipol get sense and dem dey avoid wahala;
but foolish pipol dey waka enter trobol.
17Pipol wey dey vex anyhow dey do foolish tins
and pipol hate doz wey dey deceive odas.
18Doz wey nor get sense dey wear foolishness as klot for body;
but na wisdom bi wise pipol kap.
19Wiked pipol go bow for good pipol;
dem go bow for doz wey dey fear God.
20Poor pipol neighbours hate dem,
but rish pipol get many friends.
21Na sin for yu nor to respet yor neighbour,
but doz wey dey help poor pipol,
na blessing go follow dem.
22If yu plan to do bad, yu go lost;
but if yu plan to do good,
yu go get love and faithfulnes wey nor dey fail.
23Good work dey bring gain,
but yeye word dey kause poverty!
24Money na crown for wise pipol head;
but foolish pipol work,
dey only produce bad result.
25Good witness dey save pesin life,
but wiked witness dey put pesin for trobol.
26Doz wey dey fear God, dey save
and God dey guide dia shidren.
27To fear God, na wota wey dey give pesin life
and e go help yu run from deat.
28Di king glory na wen en pipol dey plenty more-more;
but prince wey nor get savants, nor get anytin.
29Pipol wey get sense, dey kontrol demsef wen dem dey vex;
but doz wey dey kwik vex, dey show as dem foolish rish.
30Wen peace dey yor heart, e go give yor body life;
but jealousy bi like diziz for pesin bone.
31Doz wey dey opress poor pipol, dey kause God wey kreate dem,
but to help poor pipol, na to honor God.
32Na trobol dey distroy wiked pipol,
but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.
33Wisdom dey follow pesin wey dey fear God;
but yu nor fit si wisdom for where foolish pipol dey.
34Wen pipol dey fear God, dia nashon go dey great,
but sin na disgrace to evribody.
35Just as king dey happy for en wise savant,
na so too e dey vex for doz wey disgrace am.
Currently Selected:
Proverbs 14: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: