Filippians 2
2
Christian Unity
1Gain dey to serve Christ? Konfort dey for en love? Fellowship dey between pipol and God Spirit? Una heart good rish to show pipol mesi? 2Den, make una let my joy dey komplete, as una dey gri with each oda and dey love and work togeda with one mind. 3Make una nor dey karry body up, but make una trit each oda like unasef. Instead, una dey do wetin una like, bikos of di tins wey una go gain, so dat una go fit boast. 4Make una nor dey tink about unasef alone and wetin una wont, but make una dey tink about wetin good for odas too. 5Make una get di same mind wey Christ get:
6wey bi sey, even doh en with God na di same,
e nor boast about am.
7But e leave evritin wey e get for heaven
kon bi like savant.
So e kom dis world as human being.
8E put en body down kon obey God,
until Jew pipol kill and nail am for cross!
9Bikos of dis, God raiz am up
kon gi-am di name wey big pass evry oda name,
10so dat wen dem koll Jesus name,
evribody and evritin must knee down,
weda dem dey heaven, eart or for under di eart
11and evry tongue go konfess sey,
“Na Jesus Christ bi di Oga God.”
Den all di glory go bi God own.
Lite For Dis World
12So, my friends wey I love; pipol wey dey always obey mi, (nor bi only wen I dey with una, but una dey obey well-well, even wen I nor dey with una). Make una kontinue to do God work with all una heart, so dat una salvashon go full well-well, 13bikos na God dey work inside una and una go fit do good tins kon get di pawa wey go make una happy. 14Make una nor use vexnashon take work for God, 15so dat una nor go get any blame and una go dey klean. God Pikin nor get fault; even doh una dey live for di world wey bad pipol dey, una go dey shine like stars, 16bikos una get God message wey dey give life. So, di day wen Christ go kom, I go get rizin to boast sey I nor run dis race or work for nor-tin. 17But even if dem take mi offa sakrifice for una, I go dey happy, 18so make una kom follow mi rijoice.
Timoti And Epafroditus
19As Jesus Christ wont am, I go send Timoti kom meet una, so dat my heart go strong small, with di news wey I go hear about una. 20Among all di pipol for here, na only Timoti get di kind mind wey I get for una and naim dey make mi tink of una and how una dey manage. 21Di odas dey busy with dia own matter, but nor bi matter wey koncern Christ. 22Una know how mi and Timoti bi, sey as pikin dey work with en papa, na so e dey follow mi work, so dat di gospel go stand. 23I go soon send am kom meet una, so dat una go know how my kondishon bi. 24Aldo I bilive Christ sey, e nor go tey, before mi mysef go kom visit una.
25But before dat time, I don tink am sey, e good make I send Epafroditus kom meet una. En na my broda, ko-worker and soja. Na una messenja e bi and e dey help mi anytime wey I nid anytin. 26True-true, e miss all of una well-well and en mind dey worry am, bikos una hear sey e nor well. 27E sick well-well sotey e nearly die. But God get mesi for am; nor bi only for am, but for mi too, so dat I nor go kry join di one wey I dey so. 28Na dis make mi won really send am kom meet una, so dat wen una si am, belle go sweet una again and I nor go dey worry about una. 29So make una welkom and respet am as una broda for Christ with happiness, 30bikos e nearly die bikos of Christ. E put en life for danger, so dat e go fit help mi do wetin una for do, since una nor dey here.
Currently Selected:
Filippians 2: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: