Nombas 23
23
Balaam Bless Israel
1Balaam kon tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi, den bring seven melu and seven ram.” 2So Balak do wetin Balaam tok. Balak and Balaam kon give one melu and one ram as ofrin for each altar.
3Balaam tell Balak, “Make yu stand for here near yor burnt ofrin and I go-go pray and anytin wey God show mi, I go tell yu.” So only Balaam kon go on-top di hill.
4God kom meet Balaam and Balaam sey, “I don build di seven altar and I don give one melu and one ram for each one.”
5Den God tell Balaam, “Go back go meet Balak, tell am wetin I tell yu.”
6So Balaam go meet Balak for where en stand (near en burnt ofrin), both en and all di prince dem for Moab. 7Den Balaam profesai kon sey:
“King Balak for Moab bring mi kom from Aram,
from di mountin wey dey di east
kon sey, ‘Make yu kom help mi
curse Israel pipol.’
8Na how I wont take curse
pipol wey God nor curse?
Or how I go take distroy
wen God nor send mi?
9I dey si dem from where I stand on-top di rock;
I dey look dem from di hill.
Dem bi one nashon wey dey stay alone;
dem know sey dem dey bless pass oda nashon.
10Who go fit kount Jakob dust,
dem too many to kount.
Make I die as God pikin;
make I die in peace as betta man.”
Balaam Shange Pozishon
11Den Balak tell Balaam, “Wetin yu do mi so? I sey make yu help mi curse my enemy, but yu kon dey bless dem!”
12Balaam ansa, “Na only wetin God tell mi, I go fit tok.”
13Balak kon tell am, “Abeg, follow mi go anoda place where yu go si some Israel pipol, den help mi curse dem from der.” 14So Balak take Balaam go Zofim field, on-top Pisgah, where e for build seven altar kon give one melu and one ram for each of dem.
15Balaam kon tell am, “Make yu stand near yor burnt ofrin and I go-go pray to God.”
16God kom meet and tell Balaam, “Make yu go back go meet Balak kon tell am wetin I tell yu.”
17Wen Balaam kom back, e si sey Balak still stand near di burnt ofrin, with di prince dem for Moab. So Balak ask, “Na wetin God tok?”
Balaam Profesai Again
18Balaam kon profesai,
“Make una kom! Balak wey Zippor born,
make yu kom hear wetin I dey tok.
19God nor bi like man wey dey lie
and E nor bi human being wey dey shange en mind.
Anytin wey E promise, E dey do am;
Anytin wey E tok, na so e go bi.
20E don kommand mi make I bless dem
and wen God bless pesin, I nor go fit shange am.
21Wahala nor go happen to Jakob shidren;
Israel pipol nor go si trobol.
Bikos di Oga wey bi dia God dey with dem
and na-im bi di king.
22Na God take dem komot from Egypt;
E dey fight for dem like wiked melu.
23Nobody fit curse Jakob shidren;
majik nor fit wound Israel pipol.
And pipol go tok about Jakob sey,
‘Si di wonderful tins wey God don do
for Israel pipol!’
24Israel pipol go bi like strong lion
wey nor dey rest until e don distroy en enemies
kon drink di blood of di pesin wey e kill.”
Balaam Shange Pozishon Again
25Den Balak tell Balaam, “As yu nor gri curse Israel pipol, den make yu nor bless dem!”
26But Balaam ansa, “I nor tell yu sey na wetin God tell mi, na-im I go do?”
27Balak tell Balaam, “Abeg make yu kom; I go take yu go anoda place. May bi God go allow yu curse dem from der.” 28So Balak take Balaam go on-top Peor for di wildaness.
29Den Balaam tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi kon bring seven melu and seven ram.” 30So Balak do wetin Balaam tell am kon give one melu and one ram for each altar.
Currently Selected:
Nombas 23: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee