Nombas 18
18
Di Priest Work
1God tell Aaron, “Yu, yor sons and yor tribe must sofa for di Tabanako sin; but only yu and yor sons go sofa for di priest sins. 2Make yu karry yor brodas, Levi tribe and yor papa tribe follow body, so dat dem go join and help yu wen yu and yor sons dey for di tent. 3Dem must kare for yu and di whole Tabanako. But dem must nor kom near di holy tins for di Holy Place and di altar or all of una go die. 4Dem must work with yu kon kare for di tent where dem for dey do meetin and for all di work wey dey di tent, but anybody wey nor kwalifai, make e nor work with yu.
5“Na yu go kare for di sanctuary and di altar, so dat problem nor go follow Israel pipol again. 6Even mi mysef don choose yor brodas; Levi pipol for Israel. God give dem to yu as gift wey go do di work for di tent where dem for dey meet. 7But na yu and yor sons go do di priest work, evritin wey dey di altar and di Holy Place. And yu must work, bikos I don give yu di gift to bi priest and anybody wey I nor choose, if e kom near di holy tin, dem must kill-am.”
Di Priest Part
8God kon tell Aaron, “Si, I don put yu to kare for my special ofrin; I don give yu all di holy tins wey Israel pipol give mi as yu and yor sons own forever. 9Out of all di ofrin wey holy well-well wey dem nor put for fire, dis go bi yor own: evry ofrin wey bi dia own, weda na from dia korn ofrin or from dia klean ofrin, or evry ofrin wey dem give mi, go dey holy well-well for yu and yor sons. 10Yu must chop am for di Most Holy Place and evry boy pikin fit chop am, bikos e go dey holy to yu.
11“And dis na yor own: special ofrin wey kom from dia gift, togeda with all di peace ofrin wey Israel pipol give. I don give dem to yu and yor shidren forever. Evribody wey dey klean for yor family, go fit chop am.
12“I dey give yu all di best olive oil, wine, wheat and di first fruit wey Israel pipol give God. 13And any first fruit wey ripe for dia land wey dem give God, go bi yor own. Evribody wey dey klean for yor family go fit chop am.
14“Anytin for Israel wey dem give to God, go bi yor own. 15Di first-born wey dem give to God, weda na human being or animal, go bi yor own. But di first-born for pipol and di first-born from man animal wey nor dey klean, dem must replace am. 16Dem go take di shidren back wen dem don rish one mont kon pay five shekel for silva akordin to di sanctuary shekel.
17“But make yu nor take money for di first-born for melu, sheep or goat, bikos dem dey holy. Yu must kill and sprinkol dia blood for di altar kon burn dia fat for di ofrin wey dem make with fire wey get betta smell to God. 18But dia meat go bi yor own, just as di breast and di rite leg bi yor own. 19All di special ofrin for di tins wey dey holy wey Israel pipol give to God, I don give dem to yu and yor shidren forever. E go bi salt kovenant forever to God and na for yu and yor shidren-shidren.”
Levi Pipol Work
20God tell Aaron, “Yu nor get any propaty for dia land and know part for Israel land go bi yor own. Na mi God, bi evritin wey yu nid.
21“I don give Levi pipol all di tithes wey Israel pipol give mi. Dis na to pay dem for dia work wey bi to kare for di tent where dem for dey do meetin. 22Di oda Israel pipol nor go kom near di tent where dem for dey do meetin again, or dem go bear dia sin and dem go die. 23But Levi pipol must do di work for di tent where dem for dey do meetin and dem must bear dia own sin. Dis na rule forever for all Levi pipol. Levi pipol nor go get any propaty for Israel, 24bikos I don give dem di tithes wey Israel pipol give mi. Dat na why I sey dem nor go get any propaty for Israel.”
Law For Levi Pipol
25God kommand Moses: 26“Make yu go tell Levi pipol sey: ‘Wen una don kollect Israel pipol tithes wey God don give una as una own, una must divide am into ten kon give one part as special ofrin to God. 27Den God go kollect una special ofrin as E take kollect farmer own for new korn and wine. 28God special ofrin and tithes wey una kollect from Israel pipol, una go give dem to Priest Aaron. 29From all una gifts, una must give di special ofrin wey bi God own and e must bi di best and e go dey holy.’
30“So make yu Moses tell dem, ‘Wen una don give di best, una fit keep di rest, just as farmer dey keep wetin remain afta e don give en ofrin. 31Una fit chop am for anywhere; both una and una family, bikos na una salari for una work for di tent where dem for dey do meetin, bi dat. 32And una nor go kommit any sin, since na di best part una give. Una must dey kareful, so dat una nor go trit di holy tins wey Israel pipol get, anyhow, bikos if una do am, una go die.’ ”
Currently Selected:
Nombas 18: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee