YouVersion Logo
Search Icon

Nombas 16

16
Korah Sin
1Naw some pipol from Reuben tribe kon sin, dis pipol na: Korah wey Izhar born, wey Kohat born, wey Levi born with Datan and Abiram wey Eliab bi dia papa and On wey Pelet born. 2Dem with some Israel pipol (two hundred and fifty popula prince from di kommunity) kon dey tok against Moses. 3Dem gada against Moses and Aaron kon sey, “Una own don too mush sef! Di kommunity dey holy; na God get am and E dey with all of us too. Why e kon bi sey yu Moses go dey karry body for God pipol?”
4Wen Moses hear wetin dem tok, e bow for groun kon start to pray. 5Den e tell Korah and doz wey dey follow am sey, “Tumoro morning, God go show us who bi en own and who dey holy. Na only di pesin wey bi God own go fit enter en Holy Place. 6Tumoro morning yu and doz wey dey follow yu: make una bring una burn ofrin kontaina. 7Una go lite fire, put incense inside, den karry am go di altar. Den wi go si di pesin own wey God go take. Levi pipol, na una own worse pass!”
8Moses tell Korah pipol again, “Levi pipol, make una listin to mi! 9Una tink sey e nor mean anytin to God wey choose una among Israel pipol to dey near am, so dat una go fit serve am for en Tabanako kon stand and dey prish to di pipol? 10E don already give dis tins to both una and una fellow Levi pipol. And naw, una sey una won bi priest too! 11So, na God una dey gada against! Who Aaron bi wey una dey komplain about?”
12So Moses koll Datan and Abiram wey Eliab born, but dem ansa am, “Wi nor go kom. 13Di one wey yu take us komot from Egypt wey get milk and honey neva rish yu? Yu still won kill us for di wildaness as yu dey trit us like yor savant? 14Yu neva take us go any land where milk and honey full or sey yu give us where get vineyard as awa propaty. Yu tink sey yu go fit deceive us? Wi nor go kom.”
15Moses vex well-well kon tell God, “Make Yu nor asept dia ofrin. I nor tif dia animal or do any bad tin against dem.”
16Den Moses tell Korah, “Tumoro make yu and doz wey dey follow yu kom stand for God present and Aaron go kom too. 17Make each of una take en own kontaina with incense kom meet God: Both Aaron and una two hundred and fifty kontaina with incense. Each pesin among una with en own kontaina wey incense full.” 18So all of dem take dia kontaina with incense kon lite fire put, den dem stand for di tent where dem for dey do meetin door-mot, with Moses and Aaron. 19Wen Korah gada di kommunity against Moses and Aaron for di tent door-mot, God glory kon appear to di whole kommunity.
Judgement
20God tell Moses and Aaron: 21“Make una komot from among dis kommunity, so dat I go distroy dem kwik-kwik.”
22Den dem fall face groun kon sey, “My God, di God of all pipol spirit, Yu go vex for di whole kommunity wen e bi sey na only one pesin sin?”
23So God tell Moses: 24“Make yu tell di whole kommunity sey: ‘Make dem komot from Korah, Datan and Abiram tent.’ ”
25So Moses get up go meet Datan and Abiram and di eldas for Israel, follow am. 26E kon tell di kommunity sey, “Make una komot from doz wiked pipol tent and nor tosh anytin wey bi dia own, if not, God go distroy una bikos of dia sin.” 27So dem komot from Korah, Datan and Abiram tent. Den Datan and Abiram kom out kon stand for di tent door-mot with dia wifes and shidren.
28Moses kon sey, “Na so una go take know sey na God send mi kom do dis work, bikos I nor dey do am by mysef. 29If dis men die normal deat without sey God ponish dem, den nor bi God send mi. 30But if God do sometin wey neva happen before and di eart open swallow dem with all wetin dem get and dem die alive, den una go know sey dis men don rijet God.”
31Wen e tok finish, di groun under Datan and Abiram open 32kon swallow dem, with dia tent, all Korah men and with all dia propaty. 33Dem and all wetin dem get enter groun alive, den di eart klose against dem. So dem die komot di kommunity. 34Israel pipol wey dey der kon run komot wen dem hear di pipol dey kry. Dem kon dey shaut sey, “Make wi run o-o! Di eart fit swallow us too!”
35Den God send fire kon distroy di two hundred and fifty men wey lite incense.
Di Fire Pan
36God tell Moses: 37“Make yu tell Eleazar wey Aaron di priest born sey, make e pick di kontaina wey dem dey put incense komot from di fire, bikos dem dey holy, den make dem pak di shako go far. 38Di pipol wey die bikos of dia sin, make una use dia kontaina take make wetin dem go take kover di altar, bikos dem offa am to God, so dem dey klean. Dem go bi sign for Israel pipol.”
39So Eleazar take di bronze kontaina kon use dem do kover for di altar. 40Dis na warnin to Israel pipol sey, “Anybody wey nor kom from Aaron family, nor go fit burn incense to God for di altar. If not, e go die like Korah and en men.” All dis happen akordin to wetin God kommand Eleazar thru Moses.
41But for di next day, di whole kommunity kon dey komplain against Moses and Aaron sey, “Una don kill God pipol.”
42Afta dem gada against Moses and Aaron, dem turn face di tent where dem for dey do meetin kon si di kloud kover am and God glory kon appear. 43Den Moses and Aaron stand for di tent where dem for dey do meetin. 44God tell Moses, 45“Make yu komot from dis kommunity, so dat I go distroy dem naw-naw!” Moses and Aaron kon bow face groun.
46Den Moses tell Aaron, “Make yu take di kontaina with incense kon put fire inside am from di altar. Den kwik go di kommunity side go do sakrifice to make dem holy, bikos God go send one bad diziz kon meet dem, since E dey vex for dem.” 47So Aaron do wetin Moses kommand and e run enter di pipol centre. Naw di diziz just dey start among di pipol. Aaron put di incense for der kon make dem holy. 48E stand between doz wey don die and doz wey dey alive kon stop di diziz. 49Naw, di pipol wey die with di diziz na 14,700 plus di pipol wey die bikos of Korah matter. 50Afta di diziz stop, Aaron kon go meet Moses for di tent door-mot.

Currently Selected:

Nombas 16: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in