YouVersion Logo
Search Icon

Nombas 10

10
Trumpet Sound
1God tell Moses: 2“Make yu make two trumpet with silva from one hammer. Yu go use am take dey gada di kommunity and to tell dem wen dem won travel. 3Wen dem blow di two trumpet, all di kommunity must gada round yu for di tent where dem for dey do meetin door-mot. 4But if dem blow one, den di leaders and doz wey dey lead tazon go kom meet yu. 5Wen yu blow alarm, di pipol wey dey di east side must start to travel. 6Wen yu blow for di sekond time, di pipol wey dey di sout-side must start to travel. 7Yu must blow di trumpet wen yu gada di kommunity, but make yu nor sound alarm.
8“Na only di priests wey bi Aaron shidren-shidren must blow di trumpet. Dis law na forever and una must obey am from one generashon go rish anoda. 9If una go fight against enemy wey dey attack una, den una must blow di alarm and di trumpet. Mi wey bi God go kon help and save una from una enemies. 10And for di time wen una dey happy like di time for una festival or as di mont just dey start; una go blow di trumpet for una burnt ofrin and di sakrifice wey una dey do for peace ofrin, so dat God go dey remember una: Na mi bi di Oga una God.”
From Sinai To Kadesh
11For di nomba twenty day, for di sekond mont, for di sekond year, afta di pipol don komot from Egypt, di kloud kon komot from di Tabanako for di Kovenant Box. 12So Israel pipol start to travel from Sinai Wildaness. Di kloud kon kom down for Paran Wildaness.
Judah Tribe Start Di Travel
13Dis na di first time wen dem start to travel akordin to di kommand wey God give Moses. 14Just as dem take dey travel before, na so dem still dey do am. Judah tribe travel first akordin to dia family and na Nahshon wey Amminadab born dey lead dem. 15Netanel wey Zuar born, na-im dey lead Issakar tribe. 16Na Eliab wey bi Helon pikin dey lead Zebulun pipol. 17Den dem karry di Tabanako go down and Gershon and Merari shidren kon karry di Tabanako as dem kontinue dia journey.
Dem Arrange Di Tribe
18Di next tribe wey follow na Reuben pipol and dem kon dey waka with dia flag. Na Elizur wey Shedeur born dey lead dem. 19Shelumiel wey Zurishaddai born, na-im dey lead Simeon pipol. 20Den Eliasaf wey bi Deuel pikin kon dey lead Gad pipol. 21Kohat pipol waka go karry di tins for di sanctuary and before dem go rish der, dem must don karry di Tabanako up.
22Di next tribe na Efraim pipol wey dey waka with dia flag, akordin to dia family and na Elishama wey Ammihud born dey lead dem. 23Gamaliel wey Pedahzur bi en papa, na-im dey lead Manasseh tribe 24and Abidan wey Gideoni born dey lead Benjamin tribe.
25Doz wey dey Dan tribe dey waka with dia flag, na dem bi di rear guide wey dey work for all di kamp akordin to dia family; Na Ahiezer wey Ammishaddai born dey lead dem. 26Pagiel wey Okran born, na-im dey lead Asher pipol 27and Ahira wey en papa bi Enan dey lead Naftali tribe. 28Dis na di way Israel pipol take travel; family by family.
Moses Wife Broda
29Moses tell en wife broda Hobab wey en papa na Reuel wey kom from Midian sey, “Wi won start to travel go di place wey God don sey E go give us. E don promise to make Israel prosper, so make yu follow us and wi go trit yu well.”
30But Hobab ansa, “I nor go follow una, instead I go-go my own land go meet my pipol.”
31Moses kon sey, “Make yu nor leave us, bikos na Yu know where wi go stay for inside di wildaness and na yu go bi awa eye. 32If yu follow us, wi go share all di blessings wey God go give us, with yu.”
33Wen di pipol don komot from Sinai, wey bi di holy mountin, dem kon travel for three days. God Kovenant Box dey with dem for dat three days wey dem travel so and dem kon dey find where dem go fit rest put small. 34As dem dey travel, God kloud dey kover dem.
35And wen dem karry di box dey travel, Moses go sey,
“My God! Arise
make yor enemies dem skata
and make all doz wey hate Yu,
run as dem si Yu dey kom.”
36And wen di box stop, Moses go sey,
“My God! Make Yu kom back
kom meet Israel, yor pipol wey plenty.”

Currently Selected:

Nombas 10: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in