Mark 3
3
Jesus Heal Man Wey En Hand Die
1Wen Jesus enter di sinagog again, one man wey en hand die, dey der. 2Di Farisee pipol kon dey look Jesus with korna eye weda e go heal di man for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akuiz am. 3So Jesus tell di man, “Make yu stand for centre make evribody si yu.”
4Jesus kon ask, “E good make wi do good or bad tin for Sabat Day? Make wi save or distroy pesin?” But dem nor ansa.
5So Jesus vex kon look dem round, bikos dia heart strong well-well, den e tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon well again. 6Den di Farisee and Herod pipol kon kwik-kwik go outside go plan how dem go take kill Jesus.
Pipol Gada For Wotaside
7Den Jesus komot with en disciples go di wotaside and plenty pipol from Galilee follow am. Pipol from Judea, 8Jerusalem, Idumea, some from across Jordan River and around Tyre and Sidon kom meet am wen dem hear about di tins wey e dey do. 9Bikos of di pipol, Jesus kon tell en disciples make dem prepare one small boat for am, so dat pipol nor go push am anyhow. 10Jesus heal many pipol, so all di pipol wey nor well kon dey push each oda, so dat dem go fit tosh am. 11And anytime evil spirit wey dey inside some pipol body si Jesus, dem go fall for en front dey shaut, “Yu bi God Pikin.” 12But Jesus warn dem well-well make dem nor let pipol know who e bi.
Jesus Choose Twelf Disciples
13Jesus klimb go on-top mountin kon koll di pipol wey e wont, make dem kom meet am for der. 14E choose twelf pipol (wey e koll apostles), so dat dem go dey with am and e go fit send dem go prish. 15E kon give dem pawa to drive demons komot. 16Na di twelf wey e choose bi dis: Simon wey e koll Pita, 17James and en broda John, wey bi Zebedee shidren wey Jesus dey koll “Boanerges (wey mean ‘Tonda shidren’).” 18Plus Andru, Filip, Bartolomew, Matiu, Tomas, James wey bi Afaeus pikin, Taddaeus, Simon wey dem dey koll Zealot (pesin wey dey fight for en kountry), 19and Judas Iskariot, wey sell Jesus give en enemies.
Jesus And Belzibub
20Jesus go house and plenty pipol kon gada am sotey en and en disciples nor fit chop. 21Wen Jesus family hear wetin dey happen, dem kon go hold am, bikos pipol dey sey, “E don dey kraze.”
22Di law tishas wey kom from Jerusalem sey, “Belzibub dey inside am” and “Na demon pawa e take dey drive demons komot from pipol body.”
23So Jesus kon tok to di pipol for parabol sey: “How Satan go fit take drive Satan komot? 24Any kingdom where pipol dey fight each oda, nor go fit stand. 25And any family wey dey fight demsef, go skata. 26So, if Satan kingdom divide against ensef, e nor go fit stand and en end don rish. 27Nobody go fit enter strong man house tif en propaty, unless e first tie di strong man, before e go fit tif en tins. 28I tell una true word, God go forgive pipol di sins wey dem kommit and all di bad word wey dem tok. 29But anybody wey tok bad word against di Holy Spirit, God nor go ever forgi-am, bikos e don kommit sin wey go last forever.”
30Jesus tok so, bikos some pipol sey, “Evil spirit dey inside am.”
Jesus Family
31Jesus mama and en brodas kom meet am. Dem stand for outside kon send pesin go koll am. 32Di pipol wey sidan near Jesus kon tell am, “Yor mama and yor brodas dey outside, dem won si yu.”
33But Jesus ansa dem, “Who bi my mama and my brodas?”
34Den e look di pipol wey sidan round am kon tell dem, “Na my mama and my brodas bi dis pipol wey sidan here! 35Bikos anybody wey do wetin God wont, na-im bi my broda, sista and mama.”
Currently Selected:
Mark 3: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: