YouVersion Logo
Search Icon

Matiu 24

24
Dem Distroy Di Temple
1As Jesus dey komot from di temple, en disciples kon show am how di temple building bi. 2Jesus kon tell dem, “Una dey si all dis tins? I tell una true word, wen di time rish, one block nor go dey on-top anoda one, bikos di building go skata finish!”
Sign For End Time
3As Jesus sidan for Mount Olives, en disciples kom meet am for korna ask am, “Make yu tell us wen dis tins go happen? How wi go take know sey di time wen yu go kom, don rish?”
4Jesus ansa dem, “Make una shine una eye, so dat nobody go fit deceive una. 5Many pipol go kom with my name dey sey, ‘I bi Christ wey bi di Mezaya’ and dem go deceive many pipol. 6Una go dey hear rumor sey war dey happen for difren place. Make una nor fear, bikos e must happen, but di time wey I go kom, neva rish. 7One kountry go fight with anoda kountry and one kingdom go fight with anoda kingdom. Honga go dey evriwhere and eartkweke go happen for difren place. 8Wen dis tins go dey happen, e go bi like wen belle dey pain woman wey won born.”
Di Disciples Go Sofa
9“Dem go karry una wey bi my disciples give pipol wey go sofa and kill una. Bikos of mi, pipol for difren town wey nor know God, go hate una. 10Many pipol nor go gri follow mi again and dem go dey lie and hate each oda. 11Many wayo profets go kom and dem go deceive many pipol. 12Bikos pipol nor go obey God law, di love wey many pipol get for God, nor go strong again. 13But God go save di pesin wey go bear go rish end. 14Before di world go end, my pipol go prish about God Kingdom go rish evriwhere.”
Bad Tins Go Happen
15“As Profet Daniel tok, ‘Bad tins go happen for di Holy Place, inside di temple’ (Anybody wey hear dis word, make e undastand wetin e mean). 16Pipol for Judea go run go on-top mountin. 17Pesin wey dey on-top roof, make e nor kom down kon take anytin from en house 18and pesin wey dey farm, make e nor go back to en house go take en klot. 19For dis time, e go hard well-well for wimen wey get belle and doz wey get small pikin for hand. 20Make una pray sey, e nor go bi for Sabat Day or Rainin Sizin naim all dis tins go happen, 21bikos for dat time, di sofa wey go dey, go strong pass any sofa wey don happen since wen God kreate di world kom rish naw and dis kind sofa, nor go dey again. 22And if God nor reduce di days wen dis tins go happen, evribody go die finish. But bikos of di pipol wey God choose, e go reduce di days. 23So if anybody kon tell una sey, ‘Look o-o, Christ dey here or e dey der!’ Make una nor bilive am. 24Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose. 25Make una remember wetin I dey tell una so, before dem go happen.
26“So if anybody tell una sey, ‘Look, Christ dey inside bush,’ make una nor go, or ‘Look, e dey inside house,’ make una nor bilive. 27Just as tonda lite dey kom from east go west, na so e go bi wen Man Pikin go kom. 28Bikos na where dead body dey, na der vultures dey gada put.”
Man Pikin Go Kom
29“Afta di wahala wey go happen for dat time,
“Di sun go kon dark
and di moon nor go shine;
stars go fall from heaven
and heaven go dey shake.
30“Den Man Pikin sign go appear for heaven and all di tribes for dis world, go kry. Dem go si God Pikin dey kom from inside di kloud for heaven with pawa and betta glory. 31God go send en angels go blow loud trumpet and dem go gada di pipol wey E choose from evriwhere for di world.”
Fig Tree Parabol
32“Make una hear di fig tree parabol: Anytime en branches dey bring leaf kom out, pipol go know sey dry sizin don near. 33So wen una si all dis tins dey happen, make una know sey di time don rish and e dey near una door-mot. 34I tell una true word, di pipol wey dey di world for dis time, nor go die finish before all dis tins go happen. 35Heaven and eart go vanish, but my word go still dey.
Make Yu Ready!
36“Nobody know dat day or di time, even di angels for heaven nor know am, escept my Papa. 37Just like e happen for Noah time, na so Man Pikin go take kom. 38For Noah time, before di flood kom, pipol dey chop and drink, dey marry and dey give dia pikin out for marriage, until di day wen Noah enter di ark. 39Dem nor know wetin dey happen until wota kom karry dem go. Na like dat e go bi wen Man Pikin go kom. 40Dat time, two men go dey for farm; one go vanish leave di oda one. 41Two wimen go dey grind korn for engine, one go vanish leave di oda one.
42“So, make una shine una eye, bikos una nor know di day wen Christ go kom. 43But make una remember sey: If pesin wey get house know di time wen tif go kom for nite, e go ready ensef make di tif nor for enter en house. 44So, make una dey ready, bikos Man Pikin go kom for di time wen una nor tink sey e go kom.
Di Savant Wey Wise And Good
45“Who bi di savant wey wise and good? Na di pesin wey en oga make leader among di oda savants, so dat e go give dem food for di korrect time. 46E go good for dat savant wen en oga go kom back kon si am dey work. 47I tell una true word, di oga go sey, ‘Make yu kare for di whole house.’ 48But if na wiked savant, e go tell ensef, ‘My oga nor go kwik kom back’, 49so e go bigin beat di oda savants and e go dey chop and drink with drunkards. 50Wen di oga go kom back for di day wen di savant nor espect and di time wen e nor know, 51e go kut di savant to pieces kon trow am put for where pritendas dey, where e go dey kry and grind en tit.”

Currently Selected:

Matiu 24: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in