Matiu 22
22
Di Marriage Feast
1Jesus kon tok to dem again for parabol sey: 2“God Kingdom bi like wen one king do marriage for en son. 3E send en savant go koll di pipol wey dem invite kom di party, but dem nor gri kom.
4“Den e send oda savants sey, ‘Make una go tell di pipol wey wi invite sey, “Si! Di party go soon start. I don kill big melu and oda animals and evritin don ready, so make una kom for di marriage.” ’
5“But di pipol nor gri listin to wetin di savants tok, instead one go en farm and di oda kon go do en business. 6Di oda one seize di savants, beat dem anyhow and kill some. 7Di king vex well-well kon send en sojas make dem go kill di pipol wey kill en savants and make dem burn evritin for dia town.
8“Den e kon tell en savants. ‘Di marriage don start,’ di pipol wey I invite before, nor bi di pipol wey suppose kom. 9So make una go di strits and invite evribody wey una si kom di party. 10So di savants go di strits kon gada all di pipol wey dem si, both bad and good, kom di marriage and di hall kon full.
11“Wen di king si di pipol wey kom di party, e kon si one man wey nor wear marriage klot. 12So di king ask am, ‘My friend, how yu take enter here wen yu nor wear marriage klot?’ But di man nor fit ansa am.
13“Den di king tell en savants, ‘Make una tie en hand and leg trow am outside for darkness, where e go kry and grind en tit.’
14“Na only few pipol God choose from di many wey e koll.”
To Pay Tax Give Caesar
15Den di Farisee pipol komot go plan how dem go take katch Jesus with wetin e go tok. 16So dem kon send dia disciples, with some pipol wey dey support Herod, go meet Jesus sey, “Tisha, wi know sey yu dey tok trut well-well and yu dey tish wetin God wont. Yu nor dey favor anybody, bikos yu nor dey play wayo. 17Wetin yu tink? E good make wi pay tax give Caesar?”
18But Jesus know dia wiked plan, so e kon tell dem, “Una wey dey pritend! Why una one set trap for mi? 19Make una show mi di money wey una dey take pay tax.” So dem bring di money kom. 20Jesus ask dem, “Wish pesin face and name dem stamp put for di money?”
21Dem ansa, “Na Caesar own.”
Jesus kon tell dem, “Den, make una give Caesar wetin bi Caesar own and give God, wetin bi God own.”
22So wen dem hear wetin e tok, dem kon waka leave am.
Marriage And Resureshon
23For di same day, di Sadusi pipol (wey bilive sey resureshon nor dey), kom meet and ask Jesus, 24“Tisha, Moses tok sey, ‘If man wey nor get pikin die, en broda must marry en wife, so dat e go fit born pikin for en broda wey don die.’ 25Yu si, e get seven brodas wey dey stay here with us. Di first one marry, leta e kon die, since e nor get pikin, en broda kon marry en wife. 26Di same tin happen to di sekond broda and di third one, go rish di nomba seven. 27At last, di woman kon die too. 28Wen pipol wey don die go kom back to life, wish pesin wife di woman go bi out of di seven brodas wey marry am?”
29Jesus ansa dem, “Una dey make mistake, bikos una nor know God word and en pawa. 30For resureshon day, pipol nor dey marry or give woman out for marriage, bikos dem go bi like angel for heaven. 31Koncerning weda pesin wey don die go kom back to life, una neva read wetin God tell una? 32God sey, ‘I bi Abraham, Isaak and Jakob God. I nor bi God for pipol wey don die, but I bi God for pipol wey dey alive!’ ”
33Wen di pipol hear as Jesus dey tok, dem sopraiz for wetin e dey tish.
Di Kommandment Wey Big Pass
34Wen di Farisee pipol hear sey Jesus don make di Sadusi pipol kwayet, dem kon gada. 35One of dem wey bi law tish kon ask Jesus one kweshon to take try am.
36“Tisha, wish kommandment big pass?” 37Jesus ansa, “Make pesin love God with all en heart, with all en soul and with all en mind. 38Na dis bi di first kommandment and naim big pass. 39Di sekond one bi like di first one: ‘Make pesin love en neighbour as e love ensef.’ 40Na dis two kommandments, Moses Law and wetin di profets tish, dey follow.”
Di Mezaya: David Pikin And God
41As di Farisee pipol gada, Jesus kon ask dem one kweshon. 42“Wetin una tink about Christ, wey bi di Mezaya? Wish pesin pikin e bi?”
Dem kon ansa, “Na David Pikin.”
43Jesus ask dem again, “Den, how kom David koll am, ‘Oga God’, thru God Spirit, wen e sey,
44“Di OGA tell my Oga God sey,
‘Sidan for my rite hand,
until I go put all yor enemies
under yor leg.’
45If David koll am, ‘Oga God,’ den, how e kom take bi David pikin?” 46So nobody fit ansa Jesus and from dat day go, nobody try to ask am kweshon again.
Currently Selected:
Matiu 22: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee