Matiu 16
16
Pipol Ask For Sign
1Di Farisee and Sadusi pipol kom test Jesus. Dem ask am make e show dem sign from heaven.
2But Jesus tell dem, “Wen evening rish, una go sey, ‘Di weda go good bikos di sky red,’ 3and for morning, una go sey, ‘Rain go fall bikos di sky red and dark.’ Una sabi use di sky know how weda go bi, but una nor fit know di signs about di time wey God tok for en word. 4Wiked and evil pipol for dis time dey ask for sign, but dem nor go get any one, escept Jonah sign.” Den Jesus kon waka leave dem.
Di Farisee And Sadusi Pipol Yist
5Wen di disciples cross go di oda side, dem forget to take bread follow body. 6Jesus kon tell dem, “Make una guide unasef against di Farisee and Sadusi pipol yist.”
7So dem kon dey tok among demsef sey, “Na bikos wi nor bring bread, naim make am dey tok like dis.”
8Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon tell dem, “Una faith small o-o! Wetin make una dey kworel with unasef sey una nor take bread follow body? 9So una neva still undastand? Una nor remember di five bread wey I take feed 5,000 men and how many basket una gada afta dem don chop finish? 10Or di seven bread for di 4,000 men and how many basket una gada afta dem don chop finish too? 11Why una nor undastand sey I nor dey tok to una about bread? But na make una for guide unasef against wetin di Farisee and Sadusi pipol dey tish!” 12Den di disciples kon know sey nor bi bikos of bread make am dey warn dem, but na bikos of di tins wey di Farisee and Sadusi pipol dey tish.
Pita Tok Who Jesus Bi
13Wen Jesus Christ rish Caesaria for Filippi aria, e kon ask en disciples, “Na who pipol sey Man Pikin bi?”
14Dem ansa, “Some pipol sey yu bi John di Baptist, odas sey yu bi Elijah and some dey sey na Jeremaya or one oda profet naim yu bi.”
15Jesus kon ask dem, “Who una sey I bi?”
16Simon Pita ansa, “Yu bi di Mezaya, God Pikin wey dey alive.”
17Den Jesus tell am, “God go bless yu, Simon, Jonah pikin, bikos na my Papa for heaven show yu dis tin, nor bi human being. 18And I tell yu, yu bi Pita, wey mean rock and on-top dis rock, I go build my church and di gate for hell nor go fit skata am. 19I go give yu heaven key, so dat anytin wey yor prayer tie for eart, dem go tie am for heaven and anytin wey yor prayer luz for dis eart, dem go luz am for heaven.” 20Den Jesus kommand en disciples make dem nor tell anybody sey, na-im bi di Mezaya.
Jesus Tok About En Deat And Resureshon
21From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.
22So Pita take Jesus go one korna kon tell am, “Oga God! God forbid! Dis kind tin nor go ever happen to yu!”
23But Jesus turn face Pita kon sey, “Satan, komot for my front! Yu bi stone wey block road, bikos yor mind nor dey for wetin God wont, but na wetin man wont.”
24Den Jesus tell en disciples, “If anybody won follow mi, e must deny ensef, karry en cross and follow mi. 25Anybody wey won save en life, go luz am, but anybody wey luz en life bikos of mi, go gain am. 26Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul? 27God Pikin and en angels go kom inside en Papa glory, den e go reward evribody akordin to dia work. 28I tell una true word, some of una dey here wey nor go die, before God Pikin go kom back with en kingdom.”
Currently Selected:
Matiu 16: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: