YouVersion Logo
Search Icon

Luke 24

24
Jesus Wake-up From Deat
1For early morning for di first day for di week, di wimen karry di perfume wey dem prepare go di grave where dem beri Jesus put. 2Dem kon si sey dem don roll di stone komot from di grave mout, 3but wen dem enter inside, dem nor si Jesus body for der. 4As dem dey konfuse bikos of dis tin, dem kon si two men wey dia klot dey shine like lite and dem stand for korna. 5Fear katch di wimen and dem kon face groun. But di men tell dem, “Why una dey find pesin wey dey alive for where dead body dey? 6E nor dey here again, God don wake am! Una remember wetin e tell una wen e dey Galilee sey, 7‘Dem must sell Man Pikin give wiked pipol and dem go kill-am trowey and for di third day, e go wake-up.’ ”
8Den di wimen kon remember wetin Jesus tell dem, 9so dem komot from di grave kon go tell di eleven apostles and di rest pipol wetin happen. 10Na Mary Magdalin, Joanna, Mary wey bi James mama and di oda wimen wey dey with dem, na dem tell di apostles all dis tins. 11But dia word nor mean anytin to di apostles, so dem nor bilive di wimen. 12But Pita kon get up, run go di grave. E ben-down look inside and e si only di klot, den e kon go house dey wonder wetin happen.
Jesus Waka For Emmaus Road
13Dat day, two men among Jesus disciples dey waka go one village wey dem dey koll Emmaus, wey nor too far from Jerusalem. 14Dem dey tok to each oda about di tins wey happen. 15As dem dey tok, Jesus kon bigin waka with dem, 16(but Jesus nor let dem know who e bi.)
17Den Jesus kon ask dem, “Na wetin make una dey tok like dis for road?”
Dem kon stand for one place, dey sopraiz for am. 18Den one among dem, wey en name bi Kleopas, kon tell am, “Na only yu bi strenja for Jerusalem wey nor know di tins wey dey happen since?”
19Jesus ask dem, “Wish tins?”
Dem ansa, “Di tins about Jesus wey kom from Nazaret, one man wey wetin e dey tok and do show sey en na God profet 20and how awa priest oga dem and di pipol wey dey rule us kill-am trowey. 21But wi bin hope sey naim go free Israel and dis tins don happen for three days naw. 22Some wimen wey dey with us kon even sopraiz us. Dem go where dem beri am put dis morning 23and dem nor si en body for der. Dem kom back dey tok sey dem si angels wey tell dem sey Jesus dey alive. 24Den some pipol wey dey with us kon go di grave and dem si evritin as di wimen tok, but dem nor si Jesus.”
25So Jesus tell dem, “Una nor get sense and una nor dey kwik bilive wetin all di profets tok. 26Dem nor tok sey di Mezaya go must sofa all dis tins and den e go enter en glory?” 27Den e kon use wetin Moses and all di profets rite take tell dem wetin God tok about am for en word.
28As dem near di village wey dem dey go, Jesus do like sey e won waka go front, 29but dem tell am, “Make yu stay with us, bikos evening don nearly rish and day go soon dark.” So Jesus enter di village kon follow dem stay.
30E sidan for where dem dey chop; e take bread, bless am kon divide am give dem. 31At wons dia eye open and dem kon know am. Den e vanish from dia front. 32Dem kon tell each oda, “No wonder e bi like sey fire dey burn inside awa heart wen e dey tok with us for road about God!”
33So dem get up at wons go back to Jerusalem. Dem si di eleven apostles and di oda pipol wey dey with dem 34kon tell dem, “Jesus don really wake-up and e don appear to Simon!” 35Den dem tok wetin happen for road and how dem take know Jesus wen e divide di bread.
Jesus Appear For Di Last Time
36As dem still dey tok, Jesus kon stand with dem, tell dem, “Make peace dey with una.”
37But dem shok kon bigin fear, bikos dem tink sey na spirit dem dey si. 38Den Jesus kon sey, “Why una dey fear and nor bilive? 39Make una look my hand and leg and make una tosh mi: spirit nor get flesh and bone as una si sey I get.”
40Wen Jesus don tok dis one, e kon show dem en hand and leg. 41And as dem neva still bilive (bikos of dia happiness) and still dey sopraiz, Jesus ask dem, “Una get anytin to chop for here?” 42So dem kon gi-am fish wey dem don kook, 43e kon take am chop for dia front.
Jesus Last Word With Dem
44Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.”
45Den e open dia mind so dat dem go fit undastand God word 46kon tell dem, “Na wetin dem rite bi dis, ‘Di Mezaya go sofa and e go wake-up from deat for di third day 47and dem go use en name prish give pipol make dem for turn from dia sin kom meet God and di prishin go start from Jerusalem.’ 48Una bi witness for dis tins. 49I dey send wetin my Papa promise kom meet una. So make una stay for dis town until pawa go kom from heaven kon kover una.”
Jesus Go Heaven
50Den Jesus take dem go Betany kon lift en hand and bless dem. 51As e dey bless dem, God kon karry am go heaven. 52So, dem woship am kon go back to Jerusalem dey happy well-well 53and dem dey go di temple evritime, dey praiz God.

Currently Selected:

Luke 24: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy