YouVersion Logo
Search Icon

Levitikus 8

8
Aaron And En Sons
1God tell Moses, 2“Make yu take Aaron and en sons go di tent gate, bring dia garments, di anointin oil, di yong melu for di sin ofrin, di two ram and di basket of bread wey nor get yist. 3Den gada di whole kommunity for der.” 4Moses do as God kommand am and wen dem don gada, 5e kon tell dem, “Dis na wetin God kommand sey make wi do.”
Aaron Dress
6Moses bring Aaron and en sons kom out kon wosh dem with wota. 7E wear di shirt and robe give Aaron kon tie di sash for en waist. E wear priest garment wey dem design for Aaron kon tie am with belt. 8E wear di Breast Plate gi-am kon put di Urim and Tummim for inside. 9E put di priest kap for en head kon put di gold plate wey bi di holy sign for en front, just as God kommand am.
Di Tabanako, Aaron And En Sons
10Den Moses use di anointin oil take anoint di Tabanako and evritin wey dey inside, so dat e go dey holy. 11E sprinkol some anointin oil for di altar seven times; plus di vessels, wosh-hand basin and dia stand, so dat all of dem go dey holy. 12E pour some anointin oil for Aaron head, so dat e go dey holy. 13Moses take Aaron sons go front, e wear dem di shirt, put sash round dia waist kon wrap dia head, just as God kommand.
Ofrin To Make Di Priests Holy
14E bring di yong melu for di sin ofrin, den Aaron and en sons kon put dia hand for di melu head. 15Moses kill-am, take some of di blood with en finger kon put am round di horn for di altar and e pour di rest under di altar, so dat e go dey holy. 16Moses take all di fat for di intestine, di best part for di liver, di two kidney with dia fat kon burn all of dem for di altar. 17E take di remainin melu part, en skin, flesh and intestine kon go burn am outside di kamp, just as God kommand am.
18Moses bring di ram for di burnt ofrin, den Aaron and en sons put dia hand for di ram head. 19Moses kill-am kon rub di blood for di four side for di altar. 20E kut di ram small-small kon burn di head, some part and di fat on-top di altar. 21Afta Moses don wosh di intestine and di leg with wota, e kon burn all di ram on-top di altar as komplete ofrin. Na burnt ofrin wey dem give to God and God like am well-well. So, Moses do as God kommand am.
22Den Moses bring di sekond ram wey dem go use take anoint di priests, den Aaron and en sons put dia hand for di animal head. 23Moses kill-am kon take some of di blood put for Aaron rite ear, en big finger for en rite hand and for en big toe for en rite leg. 24Den e take Aaron sons go front kon put some of di blood for dia rite ear, dia big finger for dia rite hand and di big toe for dia rite leg, den Moses pour di remainin blood for di four side for di altar.
25E take di fat (di fat tail, all di fat wey dey di intestine), di best part for di liver, di two kidney with dia fat and di animal rite leg. 26Den e take one bread wey nor get yist from di basket wey dey God present; bread wey dem mix with olive oil and one biscuit kon put dem on-top di fat and di rite leg. 27E put all dis food for Aaron and en sons hand and dem kon gi-am as special gift to God. 28Den Moses take di food from dem kon burn am on-top di burnt ofrin for di altar and na di ordinashon ofrin e bi. God like dis food ofrin smell well-well. 29Den Moses take di breast kon gi-am as special gift to God. Na Moses own part for di ordinashon ram, bi dat. Moses do all wetin God kommand am.
Anointin For Aaron, En Son And Di Garments
30Moses take some anointin oil and some blood wey dey di altar kon sprinkol dem for Aaron, en sons and for dia garment. Na so e take klean dem and dia klot, so dat dem go dey holy to serve God. 31Moses tell Aaron and en sons sey, “Make una boil di meat for di tent gate kon chop am for der with di bread wey dey di ordinashon ofrin basket, just as God kommand. 32But make una burn di meat and bread wey remain. 33Una nor go komot from di tent gate for seven days, until evritin wey dem go do for una ordinashon, don finish. 34Na God kommand us sey make wi do wetin wi do today, so dat E go forgive us awa sin. 35Una must stay for di tent gate for seven days and seven nite, so dat una nor go die. Dis na wetin God kommand.” 36So Aaron and en sons kon do evritin wey God kommand thru Moses.

Currently Selected:

Levitikus 8: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in