YouVersion Logo
Search Icon

Levitikus 24

24
Lamp Stand And Bread Tabol
1God tell Moses: 2“Make yu kommand Israel pipol make dem bring pure olive oil wey fine well-well kom put for di lamp wey dey di tent, so dat lite go dey di temple. 3For evening, Aaron go lite am till morning for God present outside di curtain for di Kovenant Box front wey dey for di holy place. Dis law go dey forever. 4Aaron go kare for di lamp wey dey di lampstand and e go always dey arrange am for God present.
Bread For God
5“Una must take twelf kilogram of flower kon bake twelf bread, 6una go put di bread for two row, six-six for one row on-top di tabol wey dem kover with gold, wey dey God present. 7Una must put pure incense for each row to dey remember di bread and e go bi gift ofrin to God. 8For each Sabat Day, Aaron go always dey arrange am before God; dis na Israel pipol work forever. 9Na Aaron and en sons get di bread and dem go chop am for di holy aria, bikos na holy food wey dem offa to God.”
Wen Pesin Curse God
10E get one man, en papa kom from Egypt and en mama name na Shelomit wey Dibri from Dan tribe for Israel, born. For di kamp, di man kon dey kworel with one Israel man. 11As dem dey fight, di Israel woman pikin kon curse God name, so dem take dem go meet Moses. (En mama name na Shelomit wey bi Dibri pikin from Dan tribe.) 12Dem put am for prison dey wait for God to tell dem wetin dem go do.
13Den God tell Moses: 14“Make yu bring di man wey curse mi kom out from di kamp, anybody wey hear am dey curse go put dia hand for en head to bear witness against am sey e dey guilty and evribody for Israel go stone am till e die. 15Make yu tell Israel pipol sey anybody wey curse God, go sofa di ponishment for en sin 16and pesin wey use God name anyhow, must die. Israel pipol go stone am weda na strenja e bi or not; anybody wey use God name anyhow, go must die. 17If pesin beat pesin die, dem must kill dat pesin too. 18If pesin beat animal die, di pesin must give anoda animal to di pesin wey en animal don die, bikos di law sey, ‘Una go give life-for-life.’ 19If pesin wound en neighbour wey bi Israel pesin; just as e do am, na so dem go do am back! 20If e break en neighbour bone, dem go break en bone too; if e blind pesin eye, dem go blind en own too; if e remove pesin tit, dem go remove en own too. Anytin wey pesin do en neighbour, dem go do am back. 21Pesin wey kill any animal, go replace am. But pesin wey kill pesin, go die too. 22Dis law na for all of una, weda yu bi Israel pesin or strenja. Na mi bi di Oga una God.”
23Wen Moses don tell Israel pipol evritin finish, dem take di man go outside di kamp kon stone am die. Like dis, Israel pipol kon do as God kommand Moses.

Currently Selected:

Levitikus 24: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in