Levitikus 20
20
Family Woship
1God tell Moses: 2“Go tell Israel pipol sey, ‘Anybody among una wey give en girl pikin to Molek juju, dem must kill-am; di pipol wey dey di land must stone am die. 3Mi mysef go turn my face against dat pesin kon remove am from my pipol, bikos e don give en pikin to Molek juju and like dat, e don spoil my temple kon disgrace my name. 4If di pipol for di land nor do anytin or kill doz wey dey give dia pikin to Molek, 5mi mysef go turn against dat man and en family. I go remove am from my pipol, both en and all di pipol wey follow am woship dat juju wey dem dey koll Molek.
Doz Wey Dey Woship Dead Body Spirit
6“ ‘Di pesin wey dey go meet dead body spirit for advise, I go turn against am kon remove am from my pipol.
Holiness And To Obey God
7“ ‘Make una keep unasef holy, bikos na mi bi di Oga una God. 8Make una obey my laws, bikos na mi bi God wey make una dey holy.
Family Life And Law Against Sex
9“ ‘If anybody curse en papa and mama, dem must kill-am and en blood go dey en own head, bikos e curse en papa and mama. 10If anybody sleep with en neighbour wife, dem must kill both di man and di woman. 11If anybody sleep with en papa wife, e don disgrace en papa bi dat. So dem must kill both of dem and dia blood go dey for dia own head. 12If anybody sleep with en pikin wife, dem must kill both en and di woman wey e sleep with. Dem don kommit evil and dia blood go dey for dia own head. 13If man sleep with man like sey e dey sleep with woman, both of dem don kommit bad sin. So dem must kill two of dem and dia blood go dey for dia own head. 14If anybody sleep with woman and en dota, dat kind tin bad well-well. So dem go burn di man, di woman and en dota with fire. So make una nor allow dis kind tin happen. 15If any man sleep with animal, dem must kill di man and di animal. 16If any woman sleep with animal, una must kill di woman and di animal and dia blood go dey for dia own head. 17If anybody sleep with en own sista, weda na en papa or mama pikin and dem si each oda nakednes, na big disgrace e bi. Una must komot dem from where dia pipol dey. E don disgrace en sista, so e go bear di ponishment for en sin. 18If any man sleep with woman wey dey si en mestrateshon kon naked am, e don break di law wey tok about holiness. 19Make una nor naked una mama or papa sista, bikos anybody wey do like dat, go sofa di ponishment. 20If anybody sleep with en uncle wife, e don disgrace en uncle, so e go sofa for en sin and e nor go born before e die. 21E dey bad for man to sleep with en broda wife, bikos e don disgrace en broda; so e nor go born before e die.
Holiness And To Obey God
22“ ‘Make una make sure sey una obey all my law and kommand, so dat di land wey I won give una nor go rijet una. 23Di pipol wey I dey porshu komot from di land for una, make una nor follow dia laws, bikos I nor like all di tins wey dem dey do. 24So I tell una: una go stay di land and mi mysef go gi-am to una as una own; bikos milk and honey full am. Na mi bi di Oga una God and I don separate una from di odas. 25So una must separate di animal wey dey klean from di ones wey nor klean; di bird wey klean from di ones wey nor dey klean. Make una nor chop dem, bikos I don make una holy. 26Una must dey holy to mi, bikos mi wey bi God dey holy and I don separate una as my own.
Doz Wey Dey Woship Dead Body Spirit
27“ ‘Man or woman wey dey woship dead body spirit, dem must kill dem. Dem must stone dem die and anybody wey do dis tin go sofa di ponishment for en sin.’ ”
Currently Selected:
Levitikus 20: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: