Levitikus 12
12
Woman Wey Just Born
1God tell Moses: 2“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen woman born and di pikin na boy, e go dey unklean for seven days, bikos di mama nor dey klean wen e dey mestrate. 3For di eight day, dem go sekonsaiz di pikin. 4Bikos of di blood wey e lost, di woman go stay for thirty-three days, before e go dey klean. E must nor tosh anytin wey dey holy and e nor go enter di Tabanako, until di day wey dem go santify am, don komplete. 5If e born girl, e go dey unklean for fourteen days as e bi wen e dey mestrate and e go stay for sixty-six days, before e go dey klean.
6“ ‘Wen dem don santify am finish, weda na boy or girl e born, e go-go di tent wey dem for dey meet go give di priest one lamb wey bi one year for burnt ofrin and one pijin or dove for sin ofrin. 7Di priest go give God di ofrin kon do di sakrifice, so dat e go dey holy. Dis na wetin di woman go do afta e don born.
8“ ‘If di woman nor fit buy di lamb, e fit bring two dove or two pijin, one for burnt ofrin and di oda one for sin ofrin and di priest go do di sakrifice, so dat e go dey holy.’ ”
Currently Selected:
Levitikus 12: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee