YouVersion Logo
Search Icon

Levitikus 1

1
Sakrifice Law
1God koll Moses kon tell am from di Tabanako sey: 2“Make yu go tell Israel pipol sey, ‘Wen anybody one sakrifice animal give God, e fit use en kattle, sheep or goat.
Burnt Ofrin
3“ ‘If na burnt ofrin from en animals, e must bring man own wey dey okay kom Tabanako, so dat God go asept am. 4E go put en hand for di animal head and God go asept am as sakrifice to take forgive en sin.’ 5Den e go kill di animal for der and di priests wey bi Aaron sons go give God di blood kon put am for di four side for di altar wey dey for di tent gate. 6Den di pesin wey dey give di ofrin go remove di animal skin kon kut am small-small 7and di priests go arrange and lite firewood near di altar. 8Dem go put all di animal part for inside, plus di head and di fat. 9Di man wey dey give di ofrin must wosh di animal intestine and legs and di priest go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.
10“ ‘If di man dey give one sheep or goat, e must bi man own wey dey okay. 11E go kill-am for di nort side for di altar and di priest go put di animal blood for di four side for di altar. 12Afta di man don kut am small-small, di priest go kon put all di animal part, plus en head and fat for fire. 13Di man wey dey give di ofrin must wosh di animal intestine and legs, den di priest go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.
Bird Ofrin
14“ ‘If di man one give bird as burnt ofrin, e must bi dove or pijin. 15Di priest must offa am for di altar, e go twist en neck kon burn en head for di altar. E go remove di blood kon put am for di altar side. 16E go remove di intestine and all di tins wey dey inside kon trowey dem for di east side for di altar where dem dey put di ashes. 17E go hold di feada kon tear di body open. E nor go allow di feada fall komot, den e go burn evritin for di altar. God like dis food ofrin smell well-well.

Currently Selected:

Levitikus 1: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

Video for Levitikus 1