YouVersion Logo
Search Icon

Joshua 9

9
Dem Deceive Israel
1Wen all di kings for Jordan River west; di kountries for hill; di ones for di valley go rish Mediterranean wotaside; plus di whole Lebanon (plus Hit, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol) hear about Israel pipol and wetin dem do, 2dem kon join togeda won go fight against Joshua and Israel pipol.
3Wen di pipol for Gibeon hear wetin Joshua do to Jeriko and Ai, 4dem kon tink and do wetin dey wise. Dem kollect some food kon put tear-tear klot on-top dia donkey with wine bag wey don tear wey dem pash. 5Dem wear sandal wey dem don pash kon wear tear-tear klot. All dia bread dry and strong. 6Dem kom meet Joshua for di kamp for Gilgal kon tell en and di men for Israel sey, “Where wi from kom dey far well-well. Make una promise us sey una nor go kill us.”
7Israel men kon tell Hiv men sey, “E fit bi sey una dey stay near us. So how wi go fit make promise with una?”
8But dem kon tell Joshua, “Wi won bi yor savant.”
So Joshua tell dem, “Na who una bi and where una from kom?”
9Dem ansa, “Where yor savants from kom, far well-well and wi dey respet God, bikos wi don hear of all di tins wey E do for una for Egypt 10and di ones wey E do to di two Amor pipol king for di oda side for Jordan River and dem bi King Sihon for Heshbon and King Og for Bashan wey dey Ashtarot. 11Na awa leaders and pipol sey, ‘Make una take food for una journey go meet dem. Tell dem sey wi dey ready to bi dia savant. So make dem promise us sey dem nor go kill us.’ 12Awa bread dey warm wen wi start dis journey, but naw, e don dry kon strong. 13Di wine bag get betta wine wen wi start di journey, but make una si how dem don skata finish. Awa klot and sandals don skata, bikos di journey long well-well.”
14Di men for Israel look some of dia tins well-well, but dem forget to ask God sey wetin dem go do. 15Joshua promise dem peace kon sey e nor go kill dem. Israel leaders sef agri wetin Joshua tok.
16Three days afta dem agri with Gibeon pipol, Israel pipol kon know sey dem dey stay near dem. 17So Israel pipol go and afta three days dem kon rish di town wey Gibeon, Kefirah, Beerot and Kiriat-Jearim pipol dey stay. 18Israel pipol nor attack dem, bikos dia leaders don use Israel God name take swear sey dem nor go kill dem.
Evribody kon dey vex for di leaders, 19but di leaders kon tell di pipol sey, “Wi use Israel God take swear sey wi nor go kill dem. So naw, wi nor go fit kill dem! 20Wi must let dem live, so dat wi nor go put curse for awa head.” 21Di leaders still sey, “Make dem live.” So Gibeon pipol kon dey kut wood and karry wota for di whole kommunity, just as di leaders wont am.
22Joshua koll Gibeon pipol kon tell dem, “Wetin make una deceive us wen una sey, ‘Where wi der stay, far from una,’ wen una really dey stay near us? 23Naw, una go bi awa savants forever and una go dey kut wood and karry wota go awa God house.”
24Dem kon tell Joshua, “Wi do like dis, bikos wi hear sey na really true sey di Oga una God don kommand Moses make e give una di whole land kon kill all di pipol wey dey stay der as una rish der. Wi do like dis, bikos wi dey fear una and wi nor won die. 25So naw, wi dey under una. Make una do us wetin una tink sey dey good to do.”
26Joshua kon do as dem tok; E nor let Israel pipol kill dem 27and from dat day go, e kon make dem dey kut wood and karry wota for di kommunity and for God altar. Till today, dem still dey do dis work for where God choose sey, make dem dey woship am.

Currently Selected:

Joshua 9: pcm

Highlight

Copy

Compare

Share

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in