Joshua 8
8
Israel Distroy Ai
1God tell Joshua, “Make yu nor fear or bigin shake! Take all di sojas make una mash go Ai! Si, I dey give yu Ai king, plus di pipol and di town. 2Make yu do wetin yu do for Jeriko to Ai, en king and en pipol, but una fit keep dia animals for unasef. Naw, make una dey ready to attack di town from back!” 3Joshua and all di sojas kon mash dey go Ai town. Joshua choose 30,000 strong sojas kon send dem go for nite. 4E tell dem, “Make una hide for di town back. Make una nor too go far from di town and all of una must dey ready! 5Mi and di oda sojas go mash go di town. Wen dem kom out kon fight us like before, wi go run leave dem. 6Dem go dey porshu us until wi don draw dem go far from di town, bikos dem go sey, ‘Dem dey run from us like before.’ 7Den una go kom out from where una hide put kon distroy di town. Di Oga una God go give di town to una. 8Wen una don enter di town, make una start to burn am. Make una do as God don tok! Si, I don give una ordas.”
9Joshua send dem and dem kon go hide for di west side for Ai, between Ai and Bethel. Dat nite, Joshua stay with di sojas.
10As day just break, Joshua gada di sojas with di leaders for Israel and dem kon mash go Ai for front. 11All di sojas dey mash with am as dem near di town. Dem kon stay for di nort side for Ai wey dey di oda side for di valley. 12Joshua hide 5,000 men for di west side between Bethel and Ai. 13Di sojas dem don ready; both di ones wey dey nort and di ones wey dey hide for west. For dat nite, Joshua kon go di valley centre.
14Wen Ai king si Israel pipol, en and all en sojas kwik-kwik get up di next day go fight Israel for Arabah. But Ai king nor know sey some men hide for di town back. 15Joshua and all di sojas for Israel kon do like sey Ai men dey win dem, so dem kon dey run go di desert. 16Ai king kon sey make all en sojas porshu dem; dem porshu Joshua and e take dem far komot from dia town. 17No soja remain for Ai or Bethel; all of dem don porshu Israel pipol and dem leave di town open.
18God kon tell Joshua, “Dis swod wey dey yor hand, make yu point am face Ai, bikos I don gi-am to yu and yor sojas.” 19Wen e stresh en hand, di men wey hide before kon get up attack di town. Dem enter di town kon bigin burn am at wons.
20Wen Ai men turn back, dem si smoke from dia town dey go heaven and fear katch dem and dem nor fit run go anywhere. Dis time, di men wey dey run before go di desert kon turn back face Ai men wey dey porshu dem. 21Wen Joshua and Israel pipol si sey di men wey hide don enter di town and di town don dey katch fire, dem kon turn and bigin kill Ai men. 22For dat same time, di men wey burn di town don kom out kon fight, so Ai men kon dey di middle. Israel sojas kill all of dem. 23But dem katch di king alive, bring am kon meet Joshua.
24Wen Israel pipol don kill all di men for Ai wey porshu dem go desert, all of dem kon go back to Ai go kill evribody wey dey der. 25Na 12,000 men and wimen die dat day, plus all di men for Ai. 26Joshua still stresh en swod until Israel don kill evribody wey dey stay for Ai. 27But Israel pipol keep all Ai tins and animals for demsef, just as God tell Joshua.
28Joshua burn Ai and nobody fit stay der (na so e bi till today). 29Joshua hang Ai king for tree kon leave am for der until evening. Wen sun don go down, Joshua kon tell di sojas sey make dem take di king dead body komot for di tree. Dem trow am put for di town gate kon pak stone on-top am (na so e bi till today).
Renew Kovenant
30Den Joshua build one altar for Israel God for Mount Ebal, 31just as God savant Moses don kommand Israel pipol. As dem tok for di Law Book wey Moses rite, dem make am with stone wey dem nor kut or break or wey any iron don tosh. Dem burnt sakrifice for der kon do sakrifice for peace. 32For Israel pipol present for der, Joshua kon rite Moses Law put for di stone. 33Di pipol, rulers, leaders and judge dem stand for di two side for di box and for di Levi priests wey karry God Kovenant Box. Both Israel pipol and doz wey dey der as strenjas dey for di box front. Half of di pipol stand for Mount Gerizim front and di oda half stand for Mount Ebal front, just as God savant Moses kommand dem to do, before dem kollect di blessing.
34Den Joshua read all di word for di law, plus di blessing and di curse, just as dem rite am for di Law Book. 35Joshua read Moses kommand for all Israel pipol front, plus di wimen, shidren and strenjas wey dey stay with dem.
Currently Selected:
Joshua 8: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee