Joshua 24
24
Joshua And Di Pipol
1Joshua gada Israel pipol for Shekem. E koll Israel leaders, rulers, judge and all of dem kom God present.
2Joshua tell di pipol, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok: ‘Before-before, una grand-grand papa dey stay afta Eufrates River, plus Terah wey bi Abraham and Nahor papa. Dem woship anoda god, 3but I take una papa Abraham cross di river kon bring am kom Kanaan land. I make en shidren-shidren many and dem nor fit kount dem; I gi-am Isaak 4and Isaak born Jakob and Esau. I give Esau, Mount Seir, while Jakob and en boys shidren go Egypt.
5“ ‘I send Moses and Aaron go Egypt kon skata Egypt rish groun wen I enter di land. Den I bring una kom out from Egypt. 6Afta, I take una papa dem kom out from Egypt and wen dem waka rish di Red Sea, Egypt soja porshu dem with shariot. 7Una papa kry to God make E help dem; den di aria between una papa and Egypt sojas, God make am dark kon kill all Egypt sojas inside di sea. Wetin E do for Egypt, una si am with una own eye. Una stay tey for di desert.
8“ ‘Den I kon bring una kom Amor pipol land wey dey east for Jordan River. Dem fight with una, but I make una win dem; una kollect dia land and I distroy dem finish for una front. 9King Balak wey Zippor born for Moab kon attack Israel. E koll Balaam, Beor son sey make e curse una. 10I nor gri listin to Balaam; instead e dey tok good tins about una and I save una from en pawa.
11“ ‘Una cross Jordan River kon rish Jeriko. Di leaders for Jeriko, plus Amor, Periz, Kanaan, Hit, Girgash, Hiv and Jebus pipol kon fight una, but I make una win all of dem. 12I send fear go for una front go drive di two king for Amor. I give una viktory, even wen una nor use swod, bow or arrow. 13I give una land wey una nor work hard to get; una dey big-big towns where una nor build house put and una dey chop fruits wey dem produce for vineyard and olive wey una nor plant.’
Israel Promise to Serve God
14“Naw, make una obey God kon dey loyal as una dey woship am with betta mind. Make una forget di gods wey una grand-grand papa dey serve before-before for di oda side for di river and for Egypt and make una kom woship God. 15If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”
16Di pipol ansa, “Make God ponish us, if wi go woship anoda god! 17Bikos na di Oga awa God take wi and awa papa dem komot from sofa for Egypt kon do all doz mirakles for awa front. E still protet us wen wi dey travel pass difren kountries. 18God porshu all doz nashons komot for us, plus Amor pipol wey dey stay di land. So wi go woship di Oga God, bikos na-im bi awa God!”
19Joshua kon warn di pipol, “Una nor go fit dey woship God as E wont, bikos E dey holy. E dey jealous and E nor go forgive una if una turn from am kon sin. 20If una forget God kon go woship anoda god, E go turn against una; E go bring wahala kom meet and distroy una, even doh E trit una as pikin before.”
21Di pipol ansa Joshua, “Lie-lie! Na God wi go serve till wi die!”
22Joshua tell di pipol, “Na una bi una own witness sey una dey sey, ‘Una go serve God till una die.’ ”
Di pipol ansa, “Yes! Na wi bi awa own witness.”
23Den Joshua sey, “So make una trowey all di oda gods wey una get kon respet only di Oga wey bi Israel pipol God.”
24Di pipol tell Joshua, “Wi go woship di Oga awa God and wi go obey am.”
25Dat day, Joshua agri with di pipol kon give dem kommand and as dem go take follow am for Shekem. 26Joshua rite dis words for God book. E arrange big-big stones kon put di book on-top dem, under di oak tree near God Temple.
27Joshua tell di pipol, “Si, dis stones go bi witness against una, bikos e don hear evritin wey God tell una. E go bi witness against anybody wey deny awa God.” 28Den Joshua sey make evribody dey go and di pipol kon go back to di land wey dem divide give dem.
Joshua And Eleazar Die
29Afta all dis tins don happen, Joshua wey bi Nun pikin and God savant kon die wen e bi one hundred and ten years. 30Dem beri am for di land wey dem gi-am for Timnat-Serah for Mount Gaash nort wey dey Efraim hill kountry.
31Thru-out di time wey Joshua dey alive with doz leaders wey dey with am (before all of dem die), Israel pipol woship God. Dis leaders don si evritin wey God do for Israel pipol.
32Josef bone wey dem karry kom from Egypt, Israel pipol kon beri am for Shekem, for part of di field wey Jakob buy from Hamor sons (Na Hamor bi Shekem papa) and Jakob buy di field for one hundred silva koin.
33Eleazar wey bi Aaron pikin kon die too and dem beri am for Gibeah for di hill kountry for Efraim, where en pikin Finehas for get land.
Currently Selected:
Joshua 24: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: