Joshua 21
21
Levi Towns
1Di leaders for Levi tribe go meet Eleazar wey bi priest, Joshua wey bi Nun pikin and Israel leaders 2for Shiloh wey dey Kanaan land kon sey, “God tell Moses sey make e give us town wey wi go stay and fields for awa animals.” 3So Israel pipol give Levi tribe towns and fields from dia own, just as God don tok.
4Dem share di first ones give Kohat family. Di Levi wey bi priest Aaron shidren kon get thirteen big towns from Judah, Simeon and Benjamin tribe. 5Di rest for Kohat shidren get ten big towns from Efraim, Dan and half of Manasseh tribe.
6Gershon shidren get thirteen big towns from Issakar, Asher, Naftali and half of Manasseh tribe wey dey Bashan.
7Merari shidren and dia family get twelf big towns from Reuben, Gad and Zebulun tribe.
8So Israel pipol give Levi tribe dia towns and fields, just as God tell Moses.
9From Judah and Simeon tribe, na di towns wey dem give out bi dis. 10Dem give Kohat family from Levi tribe wey bi Aaron shidren, bikos di first share na en own.
11Dem give dem Kiriat-Arba (na Arba bi Anak papa), wey bi Hebron for di hill kountry for Judah, plus di aria wey dey near am. 12(Dem give di fields and di towns wey dey near am to Kaleb wey bi Jefunneh pikin.)
13So for Aaron shidren, di priest kon give dem Hebron (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am), Libnah, 14Jattir, Eshtemoa, 15Holon, Debir, 16Ain, Juttah and Bet-Shemesh, plus all di aria for der.
17From Benjamin tribe, dem give dem Gibeon, Gibeah, 18Anatot and Almon, plus di aria wey dey near der and all of dem na four towns.
19Di priests wey kom from Aaron family kon get thirteen towns, plus di aria for der.
20Di rest for Kohat family for Levi tribe kon get big towns from Efraim tribe and dem bi:
21Shekem (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am) wey dey Efraim kountry for di hill, Geza, 22Kibzaim and Bet-Horon, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
23From Dan tribe, dem give dem Eltekeh, Gibbeton, 24Aijalon and Gat-Rimmon, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
25From half of Manasseh tribe, dem give dem Taanak and Gat-Rimmon, plus all di aria for der and dem bi two big towns.
26Di rest for Kohat family get ten towns and dia aria.
27Dem give Gershon family for Levi tribe dis towns:
from half of Manasseh tribe, dem give dem Golan for Bashan (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am) with Beeshtarah, all di aria for der and dem bi two big towns.
28From Issakar tribe, dem give dem: Kishon, Daberat, 29Jarmut and En-Gannim, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
30From Asher tribe, dem give dem: Mishal, Abdon, 31Helkat and Rehob, plus di aria for der and dem bi four big towns.
32From Naftali tribe, dem give dem: Kedesh for Galilee (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am), Hammot-Dor and Kartan, plus all di aria for der and dem bi three big towns.
33Gershon family get thirteen towns and dia aria.
34Dis na di towns wey dem give Merari family (doz wey remain for Levi tribe).
From Zebulun tribe, dem give dem: Jokneam, Kartah, 35Dimnah and Nahalal, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
36From Reuben tribe, dem give dem: Beza, Jahza, 37Kedemot and Mefaat, plus all di aria for der and dem bi four big towns.
38From Gad tribe, dem give dem: Ramot for Gilead (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am), Mahanaim, 39Heshbon and Jazer, plus di aria for der and dem bi four big towns.
40Merari family (doz wey remain for Levi tribe) kon get twelf big towns.
41Levi tribe kon get forty-eight big towns plus dia aria among di land wey bi Israel pipol own. 42All dis towns get betta aria round am and dem resemble well-well.
43So God give Israel pipol all di land wey E promise dia grand-grand papa and dem win am kon dey stay der. 44God dey protet dem, bikos of di promise wey E make with dia grand-grand papa. E nor get any enemy wey fit fight dem. 45So, God do evritin wey E promise Israel pipol.
Currently Selected:
Joshua 21: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: