Joshua 13
13
God Tok To Joshua
1Wen Joshua don old, God kon tell am, “Yu don old and di land wey una go still fight for, many well-well 2and dem bi: Filistia pipol and Geshur aria, 3from Shihor River for Egypt east go rish di nort side wey face Ekron (dem dey koll am Kanaan aria), plus di aria wey bi di five Filistia pipol oga own for Gaza, Ashdod, Ashkelon, Gat and Ekron; plus Avvim pipol land 4go rish di sout; all di aria wey bi Kanaan own; from Arah wey dey Sidon go rish Afek and Amor pipol aria; 5Gebal pipol aria and evriwhere for Lebanon for di east. From Baal-Gad; bottom Mount Hermon go rish Lebo-Hamat.
6“I go porshu di pipol wey dey doz land komot for my pipol, Israel. All of dem wey dey stay di hill kountries from Lebanon go rish Misrefot-Maim, plus Sidon pipol, I go distroy dem, den yu go give dia land to Israel pipol, just as I tok. 7Naw, make yu divide dis land among di nine and half tribes.”
Di Land For East
8Di oda half of Manasseh tribe, Reuben tribe and Gad tribe don kollect dia land wey dey di oda side for Jordan River, just as God savant Moses divide am.
9Dia own aria go start from Aroer (wey dey near Arnon Valley), plus di town wey dey di valley centre; evriwhere for Medeba go rish Dibon 10and all di town wey Sihon king for Amor wey dey rule Heshbon get, go rish di borda. 11Dia aria na Gilead, Geshur and Maakat, plus evriwhere for Mount Hermon and Bashan go rish Salekah. 12And all King Og aria for Bashan, wey dey rule Ashtarot and Edrei (wey dey among di remainin pipol for Refah), go bi dia own too. Moses win dem kon take dia land. 13But Israel pipol nor distroy Geshur and Maakat; So Geshur and Maaka pipol dey stay with dem till today.
14But Moses nor divide land give Levi pipol as e bi sey dia propaty na di sakrifice ofrin, wey dem dey offa give di Oga wey bi Israel God, just as E tell dem.
15Moses divide land give Reuben tribe akordin to dia family.
16Dia aria start from Aroer (wey dey near Arnon Valley) plus di town wey dey di valley centre, evriwhere for Medeba, 17Heshbon and all di towns wey dey near am; plus Dibon, Bamot Baal, Bet-Baal-Meon, 18Jahza, Kedemot, Mefaat, 19Kiriataim, Sibmah, Zeret Shahar wey dey on-top di hill for di valley, 20Bet-Peor, di low land for Pisgah and Bet-Jeshimot. 21Dis na all di towns for di aria plus di ones wey King Sihon for Amor wey dey rule from Heshbon, get. Moses win en and Midian leaders wey bi Evi, Rekem, Zur, Hur and Reba (all of dem dey under King Sihon). 22Israel pipol kill Balaam (wey bi profet) wey Beor born. 23Na Reuben tribe get di borda for Jordan River. Di towns and village dey join di land wey dem give Reuben tribe. 24Moses divide land give Gad tribe akordin to dia family. 25Na dia aria bi dis: Jazer aria, all di town for Gilead and half of Ammon aria go rish Aroer near Rabbah. 26And from Heshbon go rish Ramat-Mizpah and Betonim. From Mahanaim go rish Debir aria. 27Bet-Haram valley still dey join, plus Bet-Nimrah, Sukkot and Zafon go rish di rest side for Heshbon wey King Sihon dey rule; plus di aria for Jordan River east go rish di end for Kinneret Sea. 28Na dis towns bi di land wey dem divide give Gad tribe akordin to dia family.
29Moses divide land give half of Manasseh tribe akordin to dia family.
30Dia land start from Mahanaim go rish Bashan; di whole aria where King Og for Bashan dey rule, plus di sixty towns for Havvot-Jair. 31Di land wey dem give half of Makir shidren wey Manasseh bi dia grand-grand papa na: half for Gilead land, Ashtarot and Edrei and King Og for Bashan kingdom and na akordin to dia family.
32Na so Moses sey make dem take divide di land wen e dey Moab for Jordan River east opposite Jeriko. 33Moses nor divide land as propaty for Levi tribe; dia propaty na di Oga wey bi Israel God, just as E tell dem.
Currently Selected:
Joshua 13: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: