Judges Introdushon
Introdushon
Dis book tok about all di trobol wey follow Israel pipol as dem dey break di kovenant anyhow and dis kon make dem dey sofa under oda nashons. So dem kry to God for help and God ansa dem kon raiz judges wey fight and save dem. But e nor dey tey before Israel pipol kon bigin sin again Di Judges dem na men and wimen, some na sojas and odas na ordinary pipol. Jos as Israel bi twelf tribes, na so too di books tell us about twelf judges. But as di pipol choose to go dia own way, wi kon si sey dem don rijet dia true Judge and Ruler. As di leaders and judges dey kom and go, na so too Israel pipol kon dey wont to get dia own king to rule dem.
Currently Selected:
Judges Introdushon: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee