Judges 3
3
Di Remainin Nashons
1Dis na di nashons wey God leave for di land to take test Israel pipol wey neva fight war with Kanaan pipol before. 2E leave doz nashon for der, bikos E won use dem take tish di yong pipol for Israel wey neva fight war before. 3Na di nashon dem bi dis: Filistia pipol (doz wey dey under di five Filistia rulers), all Kanaan, Sidon and Hiv pipol wey dey stay for Mount Lebanon; from Baal-Hermon mountin go rish Lebo-Hamat. 4God leave dis pipol to take test Israel pipol, weda dem go obey di kommand wey E give dem thru Moses, dia grand-grand papa.
5So Israel pipol kon dey stay among Kanaan, Hit, Amor, Perez, Hiv and Jebus pipol 6and dem marry demsef too. Israel sons marry Kanaan girls; while Israel girls marry Kanaan sons and Israel pipol kon dey serve Kanaan gods.
Otniel
7Israel pipol forget di Oga dia God; dem sin against am kon bigin serve Baal and Asherah juju. 8So God vex well-well kon send dem go serve King Kushan-Rishataim for Aram Naharaim for eight years. 9Wen Israel pipol kry give God make E help dem, God kon send one man among dem wey save dem. En name na Otniel wey en papa na Kenaz wey bi Kaleb yonga broda. 10God Spirit enter am, so e kon bi leader for Israel. E go war go fight against King Kushan-Rishataim and God kon help Otniel, win am. 11So peace kon dey di land for forty years. Den Otniel wey bi Kenaz pikin kon die.
Ehud
12Israel pipol sin against God again, so God kon give dem to King Eglon for Moab. 13King Eglon join Ammon and Amalek pipol kon fight and win Israel pipol, den dem take Jeriko town wey palm tree full. 14Israel pipol serve King Eglon for Moab, for eighteen years.
15But wen Israel pipol kry give God for help, God kon still send one man go save dem. En name na Ehud, Gera pikin. Na left hand e dey use pass and e kom from Benjamin tribe. Israel pipol send Ehud go meet King Eglon for Moab with many gift. 16Ehud make swod wey get two mout and e long small. E hide am for di rite side under en klot. 17Den e take gift go give King Eglon wey fat well-well. 18Wen Ehud don gi-am di gift, en and di men wey bring di gift kon dey go house back. 19But Ehud go back go meet King Eglon and wen e rish di Idol Stone near Gilgal, e kon tell am, “My oga, I get one sekret message for yu.”
So di king kommand en savants, “Make una kwayet!” Den e sey make dem komot from di room.
20So Ehud waka go meet Eglon for where e sidan alone for one kool room for upstair, den e sey, “I get one message from God for yu!” As King Eglon get up from en chair, 21Ehud use en left hand bring out di swod for where e hide am put kon shuk di king for belle. 22Di swod enter di King belle well-well sotey e kover di swod head. So Ehud nor fit pul di swod komot from en belle and all di king intestine kon kom out. 23Den Ehud go outside, klose and lock di door, den e kon pass di toilet run go.
24Afta Ehud don go, di king savant kon si sey di room door dey lock. Dem tink sey di king dey di toilet for di palor, 25so dem kon dey wait, but afta sometaim wen e nor kom out, dem take di key open di door kon si dia masta don die for groun.
26Ehud run pass di Idol Stone go Seirah, as di oda savants still dey wait. 27Wen e rish di hill kountry for Efraim, e blow trumpet kon koll Israel men for war; den e lead dem kom down from di hill.
28E tell dem, “Make una follow mi, bikos God don give una viktory ova una enemies, (Moab pipol).” So dem follow am kon seize di place wey Moab pipol dey pass cross go Jordan River and dem nor allow anybody cross. 29Dat day, dem kill about 10,000 men wey strong well-well for Moab and no one among dem fit eskape. 30So Israel pipol win Moab pipol dat day and peace kon dey di land for eight years.
Shamgar Judge Israel Pipol
31Afta Ehud, di next leader wey Israel get na, Shamgar, Anat pikin and en too save Israel pipol wen e use animal bone take kill 600 Filistia pipol.
Currently Selected:
Judges 3: pcm
Highlight
Copy
Compare
Share
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee