Isaya Introdushon
Introdushon
Profet Isaya tok to di whole Judah kingdom for forty years. E start from di year wen King Uzzaya die (around 740 BC), go rish wen Assyria sojas surround Jerusalem for 701 BC. Jos like all oda di profets, Isaya message na about di good kovenant wey God make with en pipol, Israel. E use songs and oda ways to diliver di message for publik. Unlike some oda profets, Isaya dey fit go meet di king wey dey rule, for en time wey e like. Dat time, e dey fit advise King Ahaz and King Hezekaya on how e feel sey God won make tins bi even wen Assyria pipol dey treaten di full Israel kingdom. Thru-out Profet Isaya book, e just dey sey Israel pipol life na to konect with doz wey dey di oda side for di world.
Isaya tell di pipol make dem always dey kare about poor pipol and doz wey nor get, make dem always dey follow and do wetin God tok and make dem dey judge well for evritin. Di kind profet wey e bi, dey always tok about di judgement wey dey kom, bikos Israel pipol fail God, but e still tok about di promise sey God go restore Israel pipol and evry oda pesin for di whole world. God dey show en korreshon thru di new tins wey E dey do. Profet Isaya message still tok about di savant wey dey kom sakrifice en life so dat wi go dey well. Di “savant song” still bi like wen God pipol dey kom back from Babilon wer dem for bi slave and as God return to en pipol, so all of dem kon turn from sin kon meet God. Doz wey rite di New Testament dey still tok about Profet Isaya wey sey Israel pipol must bring blessing kom di world and how dis tin go take hapun.
Currently Selected:
Isaya Introdushon: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee