YouVersion Logo
Search Icon

Isaya 8

8
Isaya Pikin Na Sign
1God tell mi, “Make yu take one big board kon rite dis tins put, ‘Maher-Shalal-Hash-Baz.’ ” (Wey mean, “Kwik Karry Make Yu Distroy Fast-fast.”) 2“Den take two men wey yu trust; Uriaya wey bi priest and Zekaraya wey bi Jeberekaya pikin, so dat dem go bi witness.”
3So afta sometaim, my wife kon get belle. Wen e don born awa son, God kon tell mi, “Make yu koll am, ‘Kwik karry Make Yu Distroy Fast-fast.’ 4Before di pikin go big rish to sey, ‘Papa or Mama,’ all Damaskus propaty and di tins wey dem karry from Samaria, Assyria king go kom karry dem go.”
Assyria King Dey Kom
5God tell mi again sey,
6“Bikos dis pipol rijet Shiloah kwayet wota wey dey flow pass,
but dey fear wons dem si Rezin and Pekah,
7mi wey bi God go bring kings and dia sojas kon attack Judah.
Dem go kom like Eufrates River wey dey flow well-well.
8Dem go distroy Judah like wota wey distroy tins.
Dem go spread dia feada
kon kover di land and sey, ‘O Immanuel.’ ”
9Dem go distroy di town kon skata evriwhere!
So make una listin, all di far-far land for di eart.
Make una dey ready to fight,
but dem go still distroy una!
10Even if una plan, una nor go susid.
Make una tok anytin wey una wont,
but all of dem go dey yuzles,
bikos God dey with us.
God Warn Profet Isaya
11True-true, dis na wetin God tok. E hold mi kon warn mi sey make I nor bihave like dis pipol:
12“Make yu nor join di pipol plan
and nor fear di tins wey dem dey fear.
13Make yu remember sey, mi wey bi God wey get pawa,
dey holy, so na mi yu must fear.
14Bikos I dey holy;
I bi like stone wey dey fall pipol
and rock wey dey make pipol stagga.
Yes! I bi like trap
wey go katch pipol for Jerusalem.
15Di stone and bricks go make many pipol stagga
and fall and dem go wound well-well and di trap go katch dem.”
God Warn Doz Wey Dey Tok With Dead body
16Una wey dey follow God, make una guide
and keep di message wey E give mi.
17I go really wait for God wey don rijet Jakob family;
I go wait for am.
18Si, mi and di sons wey God give mi, go bi signs and wonders for Israel pipol and na Oga God, di Pesin wey dey stay for Mount Zion, send us kom.
19But pipol go tell una make una go meet doz wey dey si vishon, so dat dem go give una message and afta dem don tok anyhow, dem go sey, “Make una go meet dead body spirits, so dat dem go help una.” 20Den make una remember God kommand and evritin wey di profets sey go happen. True-true, all di pipol wey dey si vishon, dey tok all dis tins, bikos dia mind dey dark.
Trobol Time
21Di pipol go dey waka anyhow for di land, dem nor go get hope and dem go dey hongry. So bikos of di honga and vexnashon, dem go look up kon curse dia king and God. 22Wen dem look groun, dem nor go si anytin escept trobol and darkness wey go make dem fear well-well and e nor go get how dem go take eskape.

Currently Selected:

Isaya 8: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in