Isaya 3
3
Kworel For Jerusalem
1Naw, di Oga God wey get pawa won remove evritin
and anybody wey Jerusalem and Judah pipol dey depend on.
E go still remove dia food, wota, guards,
2strong men, sojas, judge, profets,
doz wey dey si future, leaders,
3sojas oga, dia pipol, advisers
and doz wey sabi do majik.
4God sey, “I go make yong pipol rule dem
and na wiked yong men go bi dia oga.
5Dem go dey fight each oda;
Men go oppoz each oda and neighbours go fight against dia neighbour.
Yong pipol nor go respet dia senior and foolish pipol go dey
curse doz wey dem bin dey respet.”
6Time dey kom wen pesin go hold en broda hand kon sey,
“Since yu get yor own klot to wear, na yu bi awa leader.
Den yu go fit kontrol all di wahala and trobol wey wi dey face.”
7But e go ansa, “Nor bi mi, I nor fit help una.
I nor get any food or klot for my house,
so make una nor make mi una leader!”
8Yes! Jerusalem pipol own don finish and Judah town don dey fall!
Evritin wey dem dey tok and do,
dey make God vex, bikos dem dey oppoz God law.
9Dia face dey show sey dem dey guilty.
Just like di pipol for Sodom,
na so too dem dey boast about dia sin.
E bad well-well for dem,
bikos dem dey distroy demsef.
10So make una tell innocent pipol sey e go betta for dem,
bikos God go reward dem for wetin dem don do.
11But evil pipol own don finish,
bikos na wetin dem do pipol, God go do dem too.
12Wiked men dey opress my pipol and doz wey borrow dem money,
don turn to dia oga.
My pipol, una leaders dey lead una anyhow and naw, una
nor know di rite road wey una suppose follow.
God Judge En Pipol
13God don dey ready to judge.
Yes! E don ready to judge en pipol.
14God won judge doz wey dey lead en pipol.
E sey, “Na una skata di vineyard
kon pak poor pipol tins full una house.
15Why una dey wahala my pipol and sofa doz wey nor get money?
Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”
To Klean Sin
16God sey, “Si how Jerusalem wimen dey karry body up!
Dem dey waka dey karry dia head up and roll dia eyes.
Dem dey waka small-small make dia shain for dey make nois.
17But I go ponish dem,
I go kut dia hair kon shave dia head to bololo.”
18Di day dey kom wen God go kollect evritin wey dey make Jerusalem wimen dey make yanga; dat is, di ring wey dem dey wear for dia hand, head, neck 19and dia waist. E go kollect dia klot, 20dia priest kap, di majik wey dem wear for dia hands and waist; 21di rings wey dem wear for dia fingers and nose; 22all dia fine robes, gowns, koat, pus; 23dia garments wey dey show dia body; dia handkachief, dia head-tie and di long klot wey dem dey wear for dia head.
24Instead make dem dey scent well, dem go dey smell.
Instead make dem wear betta belt, dem go tie rope for waist.
Instead make dia hair fine,
hair nor go dey dia head at-all.
Na rag dem go dey wear, instead of fine klot.
Dia beauti go turn to shame!
25Di town men and doz wey strong well-well,
dem go kill all of dem for war.
26Den Zion pipol go sidan for groun dey kry and mourn,
bikos of dia pipol wey die.
Currently Selected:
Isaya 3: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: