Isaya 18
18
God Go Ponish Ethiopia
1E go bad well-well for Ethiopia,
di land where bird feada for dey make nois for river,
2where messenjas dey travel pass with boat
wey dem take soft wood make.
Di messenjas go meet pipol wey tall and get smooth skin;
pipol wey dem dey fear for evriwhere;
wey dia nashon dey strong and always dey win war
and wey river divide dia land.
3Make evribody wey dey for di world, listin!
Una go si one flag on-top di mountin,
den una go hear one trumpet sound,
4bikos dis na wetin God tell mi,
“Just as dew dey form for nite wen harvest time rish
and as sun dey shine for day time kon make evriwhere hot,
na so too I go kwayet dey look una from heaven where I dey stay.
5And before dem go gada di grapes wey don ripe
afta di new leaf don fall,
I go use my knife take kut di branches wey nor dey produce fruit
kon break all di bad branches.
6Dem go leave all di dead body for groun,
so dat birds and wild animals go chop dem.
Birds go chop dem for dry sizin
and wild animals go chop dem for rainin sizin.”
7For dat time, di pipol wey tall and get smooth skin,
wey pipol dey fear for evriwhere;

and wey river divide dia land,
go kom pay respet to God wey dey lead heaven sojas.
Dem go kom honor God wey dey lead heaven sojas
for di place wey E choose to stay for Mount Zion.
Currently Selected:
Isaya 18: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: