YouVersion Logo
Search Icon

Hibru 9

9
God House For Heaven
1Di first kovenant show how pipol go woship God for dis world. 2Di building get two rooms. Di first one where lantan-stand dey, “Na di Holy Place.” One tabol and di bread wey dem offa give God, dey der too. 3Anoda room wey dem rite, “Holy of Holies”, dey for di curtain back. 4Di gold altar where dem dey burn incense and di Kovenant Box wey dem kover with gold, dey der too. Di gold jug wey dem put manna, Aaron rod wey grow leaf and di flat stone wey dem rite di law put, dey inside dis box. 5God angels wey kover di place where God dey show mesi and forgive sins, dey on-top dis box. But dis nor bi di time for mi to esplain all dis tins give una. 6Wen all dis tins don ready, di priests dey enter di first room evriday go do dia work. 7But na only di High Priest dey enter di Holy Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, before e go offa for di pipol own, bikos dem nor know wetin dem suppose to know. 8Di Holy Spirit kon esplain sey, “Di way to rish di Holy Place neva open as long as di old tent still dey.” 9Dis na sign make wi for fit undastand sey: Di gifts and sakrifice wey di priests dey offa for God pipol, nor fit make dia mind klean. 10To chop, drink and to do serimony take klean pesin body, na-im koncern dem. All dis one na rule for dis world, until di time wen God go bring di new law.
Christ Work
11So Christ don bi High Priest for di good tins wey don kom. E don enter di Holy Place for heaven wey dey pafet. Nor bi human being make di place and e nor dey among tins wey God kreate for dis world. 12Na wons Jesus enter di place wey holy pass. E nor enter with goat or ram blood, but na with en own blood, so e don save us forever and ever. 13If goat or ram blood and ashes fit klean pesin akordin to di old tradishon, 14wot of Christ blood wey klean us from deat, so dat wi go fit woship God? Dis na di Christ wey offa ensef to God as di rite sakrifice for awa sins and e do am with di Holy Spirit pawa.
15Na dis make am bi middo-man for di new kovenant, so dat pipol wey e koll go fit receive di propaty wey go dey forever. E promise us dis propaty, wen e die to free us from di bad-bad tins wey wi don do wen di first kovenant still dey. 16Dis kind agriment bi like pesin will. Di pesin must die first, before dem go fit use di will. 17Bikos pesin will nor dey mean anytin wen e still dey alive; e only dey yuzful wen di pesin don die. 18Na dis make di first kovenant nor get pawa to save pipol, unless dem sakrifice blood. 19Wen Moses read all di kommand give Israel pipol, e take goat and ram blood with wota and soap, kon sprinkol di blood on-top di Law Book and all di pipol body, den e sey, 20“Na dis bi di blood for di kovenant wey God kommand sey una must obey.” 21Moses still sprinkol di blood for di tent and all di plate wey dem dey use take woship God. 22True-true, akordin to di law, na almost evritin blood dey make klean and if dem neva pour blood, God nor go forgive dem dia sins. 23Na dis make dem dey klean di Holy Place for dis eart with animal blood, bikos e bi like di one for heaven. But di tins wey dey for heaven, nid sakrifice wey betta pass dat one. 24Christ nor enter di Holy Place wey human being build like di original building for heaven, but na heaven e enter and naw, e stand for God present for awa sake. 25Christ nor nid to offa ensef evry year like di High Priests dey do for di temple with animal blood, 26bikos if na so, Christ for dey kom die for us evry year since di time wey God kreate di world. But nor bi so! E die wons and for all, so dat awa sins go-go forever. 27Bikos God sey, na only wons man go die and afta dat, judgement go kom, 28na so too Christ die wons, as sakrifice to forgive pipol forever and naw, e go bring salvashon to doz wey dey wait for am.

Currently Selected:

Hibru 9: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in