Hibru 7
7
Melkizedek Na Priest
1Melkizedek wey bi “Salem king” and “God priest”, na-im bless Abraham, afta Abraham don win di kings for war. 2So Abraham kon gi-am one from evry ten tin wey e bring kom back from war. Melkizedek mean, “King wey dey do wetin dey rite” and Salem mean, “Peace.” 3E nor get papa or mama, e nor get story at-all, en days nor get where e for start or where e go end, but e bi like Man Pikin and e bi priest forever. 4But si how e big rish, bikos Abraham (awa grand-grand papa wey evribody know) gi-am one out of evry ten tins wey e bring from war. 5Levi shidren wey bi priests, get pawa akordin to di law, to kollect one out of evry ten tins from dia own pipol, even doh di pipol demsef, na Abraham shidren too. 6But Melkizedek wey nor even rilate to Levi pipol, still kollect one out of evry ten tins from Abraham, den e kon bless Abraham wey God don promise. 7True-true, wi know sey pesin wey bless pesin, na-im big pass di pesin wey e bless. 8Evry priests dey kollect one out of evry ten tins wey pipol bring, but dem nor dey stay for di world forever, esept Melkizedek, bikos God word tish us sey, e dey alive. 9Levi shidren dey kollect one out of evry ten tins from pipol, but naw, wi go fit sey, wen Abraham give one out of evry ten to Melkizedek, Levi pay too, 10bikos dat time wen Abraham give one out of evry ten tins wey e bring from war to Melkizedek, dem neva born Levi, but Levi dey inside am.
Jesus Na Priest As Melkizedek Bi
11Even doh Moses Law sey priest must kom from Levi family, dat kind priest nor fit make pesin dey pafet. So anoda priest like Melkizedek must kom and e nor bi like priest wey kom from Aaron family. 12Since dem don shange di rule to selet priest, di law must shange too. 13Di pesin wey wi dey tok about, na awa Oga God wey kom from di tribe where nobody don ever serve as priest for altar before. 14Evribody know sey na from Judah tribe, Jesus from kom and Moses Law nor sey make priest kom from dat tribe. 15Dis matter klear well-well afta God selet anoda priest like Melkizedek. 16E nor selet dat pesin bikos of en grand-grand papa dem, but na bikos en life nor go ever end. 17God word sey: “Yu bi priest forever, just as Melkizedek bi.” 18Bikos of dis, God put di old law for korna, since e dey weak and yuzles, 19bikos di law nor fit make anytin dey pafet. But naw, wi get betta hope wey go draw us near God. 20God ensef make promise wen E choose dis priest, wey bi Jesus. E nor make dis kind promise wen E choose di oda priests, 21but Jesus kon bi priest wen God sey, “I don swear and I nor go shange my mind sey yu go bi priest forever.” 22Bikos God swear like dis, Jesus don make us dey sure of di new kovenant wey betta pass. 23Many priests don dey before and all of dem die, 24but Jesus nor go ever die. So, e go bi priest forever. 25So, di pipol wey Jesus take go meet God, e go save dem for forever and ever, bikos e dey alive to pray for dem. 26Na Jesus bi di High Priest wey wi nid. E nor dey do bad tin; e dey holy; nor dey make mistake and e nor bi like wi, wey bi sinnas. God praiz am pass evritin wey dey heaven 27and e betta pass any oda high priests. Jesus nor nid to offa sakrifice evriday, like di oda priests wey dey offa for dia own sins and for di pipol own. Bikos na wons and for all e sakrifice ensef for evribody, wen e die for di cross. 28Moses Law choose human being wey get weakness as High Priest, but God promise wey kom afta di law, choose di pikin and na-im bi di korrect Priest forever.
Currently Selected:
Hibru 7: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: