YouVersion Logo
Search Icon

Hibru 13

13
Last Word
1Make una dey love each oda like Christian brodas and sistas. 2Make una always dey welkom strenja for una house, bikos like dis, some pipol don welkom angel enter dia house and dem nor know. 3Make una remember doz wey dey prison, like sey unasef dey der with dem and make una remember doz wey dey sofa, like sey una dey sofa like dem. 4Make evribody respet marriage: una must make sure sey una nor sleep with who nor bi una husband or wife, bikos God go judge pipol wey dey sleep with who dem nor marry and pipol wey don marry, wey dey sleep with oda pipol. 5Make una nor love money and make wetin una get rish una, bikos God sey, “I nor go ever leave or abandon yu.” 6So make wi get mind wey go make us fit sey, “Na God bi my helpa, so wi nor go fear. Wetin human being go fit do us?” 7Make una remember una leaders wey tish una God word; make una tink about di kind life wey dem dey live, den make una follow dia faith. 8Jesus Christ na di same yestiday, today and forever, e nor dey shange! 9Make una nor let difren-difren prishin wey una nor know turn una head. Una spiritual pawa dey kom from God grace, nor bi from food wey dem sakrifice, bikos di sakrifice nor fit help pipol wey dey do am. 10Wi get altar where di workers for di Tabanako nor fit chop from. 11Di High Priest dey karry animal blood enter di Holy Place as ofrin for sins, but di animal body, na outside di kamp dem for dey burn am. 12Derfor, Jesus take en own blood make sakrifice, so dat en pipol go dey holy. So Jesus Christ sofa outside di kamp too. 13Wi must go meet am for outside di kamp kon share di shame with am. 14Bikos for here, wi nor get any town wey go last, but wi dey wait di town wey go kom. 15True Christ, make wi kontinue to dey give God praiz as awa sakrifice. So, make wetin dey kom out from awa mout bi, “Na Jesus, bi Oga God.” 16Make una nor forget to do good and to share wetin una get with each oda, bikos doz kind sakrifice, dey make belle sweet God.
17Make una obey una leaders and do evritin wey dem tok, bikos na dem dey kare for una soul and dem go ansa God wen E ask dem how dem do dia work. Make una let dem do am with happiness, nor bi with komplain, bikos una nor go get any betta tin from am. 18Make una pray for us, bikos wi dey sure sey awa mind klean and wi won live awa life for di korrect way. 19Abeg, make una pray well-well, so dat dem go free mi and I go fit kom meet una soon.
Klosin Prayer
20God wey get peace, di Pesin wey use di everlastin kovenant blood bring awa Oga God Jesus Christ kom back from deat; awa Oga God wey dey look di sheep, 21make E give una evritin wey una nid to do wetin E wont. Anytin wey good for en eye, make E do am inside us thru Jesus Christ. Make all glory bi Jesus Christ own forever and ever. Amen!
22My brodas and sistas, I dey beg una, make una get patient and listin to di advise wey dey dis my leta, bikos wetin I rite, nor long. 23Make una know sey dem don release awa broda Timoti from prison. If e kwik kom, e go follow mi kom si una. 24Make una greet all una leaders and all God pipol. God pipol for Italy dey greet una. 25Make God grace dey with all of una.

Currently Selected:

Hibru 13: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in