Hibru 12
12
God Awa Papa
1Since wi get many witness wey surround us, e good make wi drop evry load and sin wey dey make us fall, so dat wi go use awa mind live di life wey God wont. 2Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne. 3If una dey tink how Jesus sofa for wiked pipol hand and how dem hate am, una mind go strong for faith. 4As una dey struggol make una nor for sin, una struggol neva rish to kill una as Christ die. 5Abi una don forget di advise wey God tell una as en shidren?
“My pikin, make yu listin well-well
wen God dey korrect yu
and nor vex wen God ponish yu.
6Bikos na di pesin wey God love,
na-im E dey korrect
and E dey ponish all di shidren
wey bi en own.”
7So make una bear as una dey sofa, since e bi sey na una Papa dey ponish una; dat one go show sey God dey trit una like en shidren. Abi e get pikin wey en papa nor dey ponish? 8But if God nor ponish yu as e dey ponish all en shidren, dat mean sey yu nor bi betta pikin and yu nor get papa. 9If awa papa for eart ponish us and wi dey respet dem, e nor good make God ponish us, so dat awa life go betta? 10Awa papa dey ponish us for dis world as e good for dia eye, but God dey ponish us for awa own good, so dat wi go follow am share en holiness. 11No ponishment dey sweet pesin wen dem dey ponish am, bikos e dey pain. But di pesin wey God ponish, go get life wey nor dey end. 12So una hands and knees wey don taya, make una make dem strong. 13And make una waka for strait road, so dat una leg wey don taya, go strong.
Nor Rijet God Warnin
14Make una try to live for peace with evribody and dey holy, bikos anybody wey nor dey holy, nor go si God. 15Make una make sure sey nobody turn back from God grace and make nobody get bad belle and kause trobol wey go make pipol sin. 16Make una make sure sey nobody dey do bad tins or nor dey fear God, just like Esau wey sell en rite as first-born, bikos of food. 17Una know how e try to get am back leta, but e nor fit, even doh e beg and kry give en papa. 18Una don rish Mount Sinai, where God for tok to Israel pipol. For der, fire dey burn, darkness dey der and storm and 19trumpet kon dey make nois. Israel pipol hear God vois, so dem beg am make E stop, 20bikos dem nor fit bear en kommand wey sey, “Make una kill any animal wey tosh di mountin.” 21Wetin happen dey make pesin fear, so Moses kon sey, “I dey fear and dey shake.” 22Instead, una don kom Mount Zion; di town where God dey stay; di Jerusalem for heaven where tazon angels dey. Una don enter di assembly, 23di place where all di first-born gada and dis na di pipol wey God rite dia name for heaven. Una don kom meet God wey go judge evribody and na-im dey make pipol pafet. 24Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.
25Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven? 26For dat time, en vois dey shake di eart, but naw, E don promise sey, “Nor bi only dis eart I go shake, but I go shake di heavens too.” 27Dis mean sey di tins for eart go shake komot and na only di tins wey God nor won shake, go remain. 28Since wi don receive di kingdom wey dem nor fit skata, make wi tank and woship God with respet and fear. Make wi gi-am di kind woship wey go make belle sweet am. 29Bikos awa God na big and strong fire wey dey distroy tins.
Currently Selected:
Hibru 12: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee