YouVersion Logo
Search Icon

Jenesis 9

9
God Make Kovenant With Noah
1Den God bless Noah and en shidren kon tell dem, “Make una born full di eart. 2Evritin wey I kreate for dis eart go dey fear una, both animals and birds for sky. Evritin wey dey creep for groun and di fish for inside sea, go dey under una pawa. 3Una fit chop anytin wey still dey waka. As I give una di green plant, na so too I don give una evritin. 4But make una nor chop meat wen en blood still dey inside am. 5If anybody kill pesin, I go ponish am. I go kill any animal wey kill human being.
6“Na as God bi, dem make man,
so anybody wey kill pesin,
na so too anoda pesin go kill-am.
7But yu go get many shidren and dem go many kon full di whole eart.”
8God kon tell Noah and en sons sey, 9“Si! I dey make my kovenant with yu and yor shidren-shidren 10and with evritin wey dey alive: all di birds and animals, evritin wey follow yu kom out from di boat. 11Na with dis word I take enter kovenant with yu; I promise sey I nor go ever distroy di eart with wota again.” 12And God sey, “Dis na di sign for di kovenant wey I dey make with yu and evritin wey get life and dis kovenant na from one generashon go rish anoda: 13I go use rainbow as sign for di sky and e go bi sign for di kovenant wey I make with di eart. 14Wen ever I bring kloud make e kover di eart and di rainbow sign appear for di sky, 15den I go remember di kovenant wey I make with una and evritin wey get life akordin to how dem bi. Wota nor go ever kom distroy di eart and evritin wey get life again. 16Wen di rainbow dey for di kloud, I go si am kon remember di everlastin kovenant between mi and evritin wey get life for dis eart.” 17So God tell Noah, “Dis na sign for di kovenant wey I make between mi and evritin wey get life for dis eart.”
Noah Curse Kanaan
18Noah sons wey kom out from di boat na Shem, Ham and Jafet. (Na Ham bi Kanaan pipol papa.) 19Dis na Noah sons and from dem, pipol kon full di whole eart. 20Noah wey bi farmer na-im bi di first man to plant vineyard. 21Wen e drink some for di wine, di drink kon katch am and e naked for inside di tent. 22Ham wey bi Kanaan papa kon si sey en papa dey naked and e kon tell en two brodas wey dey outside. 23Shem and Jafet take di klot kon put am for dia shoulder. Den dem kon take back waka enter kon kover dia papa nakednes. 24Wen Noah wake-up from en sleep, e kon si wetin e sons do to am. 25So e sey,
“I curse Kanaan!
Na en go bi slave to en brodas.”
26E still sey,
“Make wi praiz God wey bi Shem God and Kanaan go bi en savant.
27Anytin wey Jafet put en hand,
God go make am betta!
Make e stay Shem tent
and Kanaan go bi en savant!”
28Afta di rain, Noah stay for three hundred and fifty years. 29Di total life wey Noah stay na nine hundred and fifty years, den e kon die.

Currently Selected:

Jenesis 9: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy