Jenesis 50
50
Dem Beri Jakob
1Den Josef kiss en papa for face kon kry well-well, bikos of am. 2Josef kon tell di doctor sey make e dress di dead body, so di doctor kon dress Israel (wey bi Jakob). 3E dress am well, so dat di body go fit dey der for forty day, bikos dat na di normal time wey di body suppose last. Egypt pipol use seventy days take mourn for am. 4Wen dem don mourn finish, Josef kon tell Fero ofisas, “If really sey una like mi, make una tell Fero sey, 5‘My papa make mi swear wen e sey, “I go soon die. Make yu beri mi for di grave wey I dig for mysef for Kanaan.” Naw make I go beri my papa; den I go kom back.’ ”
6So Fero sey, “Make yu go beri yor papa, just as e make yu swear sey yu go do.” 7So Josef go beri en papa and all Fero ofisas follow am go; from di senior ofisas go rish di oda ones for di hold Egypt, 8Josef family, en brodas and en papa family. But dem leave di small-small shidren and dia animal for Goshen. 9War horse and di driver still follow am go, so pipol wey follow am many well-well.
10Wen dem rish Atad aria for di oda side for Jordan River, dem mourn and kry for der well-well. Na for der Josef for mourn seven days for en papa. 11Wen Kanaan pipol wey dey stay di land si dem dey mourn for Atad, dem kon sey, “Wetin happen nor good at-all for Egypt pipol.” Dat na why dem dey koll di place Abel Mizraim and e dey afta Jordan River. 12So Jakob shidren do for am, just as e kommand dem before. 13En sons karry am go Kanaan kon beri am for di grave wey dey Makpelah field near Mamre. Dis na di field wey Abraham buy as burial groun from Efron wey bi Hit pesin. 14Afta Josef don beri en papa, e kon go back to Egypt with en brodas and evribody wey follow am.
Josef Promise En Brodas
15Wen Josef brodas si sey dia papa don die, dem kon sey, “Wot of if Josef still dey vex and e kon sey e go ponish us for evritin wey wi do am?” 16So dem kon go tell Josef sey, “Yor papa give dis kommand before e die sey: 17‘Make una tell Josef: “Make yu forgive yor brodas dia sins and di bad tins wey dem do yu.” ’ Naw make yu forgive di sins wey yor broda God savant, kommit.” Wen dem tell Josef di message, Josef kry well-well. 18Den en brodas kom fall for en front dey sey, “Na wi bi dis and wi bi yor savants.”
19But Josef ansa dem, “Make una nor fear. Na God know wetin E won do. 20Even doh una mind na to kill mi, but God let am bi like dat, make betta tins for happen, so dat many pipol go dey save as una dey si today so. 21So, make una nor fear. Evritin wey una wont, I go give una and una shidren and family.” Den e follow dem tok well.
Josef Die
22Josef stay for Egypt with en papa family. Josef stay for one hundred and ten years. 23Josef si Efraim shidren-shidren. E still si Manasseh pikin Makir and en shidren; Josef give dem betta land and propaty.
24Den Josef tell en brodas, “Na die I dey so. But God go true-true kom meet and take una go di land wey E promise sey E go give Abraham, Isaak and Jakob.”
25Josef kon make Israel pipol swear. E tell dem, “God go really kom meet una. Den una must karry my bones follow body komot from dis place.” 26So Josef die wen e bi one hundred and ten years. Afta dem don dress en body dem kon put am for one koffin for Egypt.
Currently Selected:
Jenesis 50: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee