YouVersion Logo
Search Icon

Jenesis 13

13
Abram And Lot
1So Abram komot from Egypt kon go Negev. E take en wife, Lot and evritin wey e get follow body. 2(Naw, Abram get many animals, silva and gold.) 3E dey travel from one place go anoda, from Negev go rish Bethel. Den e kom back to di place wey dey between Bethel and Ai, where e for first put en tent. 4Dis na di place where e for first build altar. So Abram kon woship God for der.
5Lot wey dey travel with Abram, still get animals and propaty too. 6So di land nor big rish for di two of dem, bikos dem dey togeda and dia animals too many. 7So Abram men and Lot men wey dey look afta dia animals kon bigin kworel. (For dat time, na Kanaan and Periz pipol dey stay for di land.)
8Abram kon tell Lot, “Make mi and yu nor kworel and make awa men nor kworel too, bikos wi bi brodas. 9So make wi separate. Choose any part for di land wey yu wont. Make yu go one side, while I go-go di oda side.”
10Lot look well-well from Jordan River aria go rish Zoar. E kon know sey evriwhere for der get betta green plant and dem get betta wota like Oga God gardin for Egypt. (Dis na before God distroy Sodom and Gomorrah.) 11So Lot choose di whole River Valley for ensef kon waka go di east side. Dis na how Abram and Lot take separate. 12Abram stay for Kanaan and Lot kon stay for di town wey dey di valley and e kamp near Sodom 13wey en pipol wiked and dey sin against God.
Abram Go Hebron
14Afta Lot don go, God kon tell Abram sey, “Make yu look from di place where yu stand to di nort, sout, east and west. 15All di land wey yu dey si so, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren forever. 16And I go make yor shidren-shidren plenty like san-san for di eart and nobody go fit kount dem. 17So make yu get up go look di land dem, bikos I go gi-am to yu.” 18So Abram karry en tent kon go stay near Mamre oak wey dey Hebron and e build anoda altar for God for der.

Currently Selected:

Jenesis 13: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy