Galatians 4
4
Law And Freedom
1Wetin I mean bi sey, di pesin wey inherit en papa propaty and e still bi small pikin, e nor dey difren from savant, even doh na en get evritin. 2But e go dey under who dey guide am, until di time wey en papa tok, go rish. 3Na so e bi with us wen wi small; wi dey under di pawa wey dey kontrol dis world, 4but wen di rite time rish, God kon send en pikin wey woman born under di law, 5make e save pipol wey dey under di law, so dat God go make us en own shidren kon give us awa own propaty. 6Since wi bi God shidren, E put en Holy Spirit inside us and naim make us dey fit koll am, “Abba! Fada!” 7So, una nor bi slave again, but una don bi God pikin and since una bi God shidren, una go get God propaty too.
God Shidren Nor Dey Under Law
8Before-before, wen una nor know God, una dey do bad-bad tins. 9But naw wey una don know am (or abi make I sey God don know una), why una still dey follow all dis weak and yeye pawas? Una won bi dia slave again? 10Dat time, una follow dia tradishon. 11I dey fear sey make di work wey I do among una, nor waste. 12My brodas and sistas, Abeg, make una bi like mi, as I don bi like una, bikos una nor do mi any bad tin!
Paul Beg
13But wen I first prish di gospel give una, una know sey I nor well, 14even doh my sickness na problem to una, una nor laf or drive mi. Instead, una welkom mi like God angel; like sey na mi bi Jesus Christ! 15Naw, na wetin don happen to una happiness? I know sey, if to sey e dey possibol, una for pul una eye give mi! 16So, I don bikom una enemy, bikos I dey tell una di trut?
17Di pipol wey won deceive una dey trit una well, but dem nor dey do am with betta mind; bikos dem wont make una leave mi kon follow dem. 18But e good make una dey trit odas well, so-far una dey do am with betta mind and nor bi only wen I dey with una. 19My shidren! Just like woman wey won born, I dey feel pain for una, until Christ pawa go dey inside una life! 20How I wish sey I dey with una naw, so dat I go know how to trit una, bikos I dey worry about una well-well.
Paul Give Ezample
21Make una tell mi, wish of una won dey under di law? Una nor know wetin di law tok? 22Dem rite am sey, Abraham get two boys, one wey di savant woman born and di oda pikin, na di really wife born am. 23Di one wey savant born, na ordinary pikin e bi, but na thru God promise di really wife take born. 24Betta sense dey for dis story, bikos dis two wimen bi like two kovenant. One na from Mount Sinai wey bi like di shidren wey Hagar, di slave woman, born. 25Hagar bi like Mount Sinai for Arabia kountry and na di same with Jerusalem wey dey naw, bikos e dey inside der as slave with en pikin. 26But di Jerusalem wey kom from heaven, dey free and na-im bi awa mama. 27Bikos dem rite am sey:
“Woman! Yu wey neva born,
make yu shaut dey happy,
bikos yu neva labor like woman wey won born.
Di woman wey neva born,
get plenty shidren pass di woman wey get husband.”
28But my brodas and sistas, una bi shidren wey get promise, just as Isaak bi. 29For dat time, di one wey dem born for normal way, trobol di one wey dem born with di Spirit and na so e bi with una naw. 30But wetin dem rite for God word? “Make yu drive di savant woman and en pikin komot, bikos di savant pikin nor go share with di pikin wey di really wife born.” 31So my brodas and sistas, wi nor bi savant shidren. Na di really woman shidren, wi bi.
Currently Selected:
Galatians 4: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

: